‘Na pepper na im dem put for my eyes so, I need justice for Favour’ – Mama of 20-year-old Favour cry bitterly

Wia dis foto come from,BBC/ Favour Agbro tiktok

Wetin we call dis foto, Foto mix of Mrs Agbro wey be di late Favour Agbro mother.
    • Author,Tamara Ebiwei
    • Role,Broadcast Journalist
    • Reporting from,Abuja, Nigeria
  • Published20 July 2026
  • Read am in 7 mins

“She be my best friend, Favour na my favourite, she be one of my best, she be part of my rib, she be part of my kidney, I know who my daughter be.” Dis na wetin di mother of di late Favour Agbro tok as she still dey mourn di death of her daughter.

Mrs Agbro continue to lament di loss of her 20 years old daughter wey kpai hersef afta one popular social media content creator, Odogwu-Asaba allegedly rape her.

On 15 July, 2026, di Delta State Police Command bin announce say dem don arrest di suspect on top accuse say e rape one 20-year-old girl.

“Police don arrest Ifeanyi Ogbonna, male, wey be 40 years, e also dey popularly known as “Odogwu of Asaba,” in connection wit di alleged rape of a 20-year-old woman, wey later die.”

Police say dem arrest am afta dem receive petition for di command wey allege say on 1 June 2026, di girl bin travel go Asaba wen di suspect bin invite her.

Di content creator Ifeanyi Ogbonna wey pipo sabi as Odogwu Asaba chop arrest on Tuesday, police confam.

Even though di suspect still dey for police custody, Mrs Agbro say her life no be di same again, as she and her family dey mourn di loss of Favour.

Skip content and continue reading

Mrs Agbro narrative wetin her pikin tell her bifor her untimely death.

“Favour bin tell me say mummy, e get one guy wey I dey chat on Facebook and TikTok, im name na Odogwu-Asaba, Odogwu of Asaba. She say she tell di guy say she need im back up to back her up so dat she go fit go viral.

My daughter come tell am say abeg o! I be virgin o, I neva do am once o. I hope di back up wey you wan back me up, I hope you no go take anytin from me o! Abeg o, I still be small girl o!

E come ask her say how many years you dey? She say she be 20 years.”

According to mama Favour, she tell her daughter say make she no go, except she drop di guy number so dat two of dem go fit dey tok for phone and also know wia im dey stay, bifor she go allow her go.

“On di 8th my daughter come call me. She call me, she dey cry. I say Favour wetin dey happun to you? E say mummy please I don disappoint you. Bifor I hear, dem say my daughter don already drink Sniper, for wia I travel go, na dia dem take call me say right now dem don rush my daughter go hospital say make I come hospital.

Di mother of twin girls tok say na sake of threat make her daughter kapi hersef.

“Na di threat wey Odogwu of Asaba dey threaten her na im give her dat pressure becos e dey use di juju of im town take dey swear, say im go use di juju take kpai her, say im don summon her for di juju.

“I no dey use my daughter dey look for money o. You wey be mama for dia and you wey be papa for dia, even though say una neva even born, remember say tomorrow you go be papa, you go be mama, make una feel my pain.

“Na pepper na im dem put for my eye so. I need justice for Favour!” she tok as she dey cry.

Wia dis foto come from,Agbro family

Wetin we call dis foto, Close shot of Mrs Agbro hand wey hold foto of her chidldren. Di late Favour and her sister Faith wit dia brother pose wit wetin resemble birthday cake.

‘She no gree tell me why she dey go Asaba or di pesin she dey go meet’ – Faith Agbro

Faith Agbro wey be di twin sister to di late Favour Agbro say she learn to speak-up and speak-up for hersef sake of Favour.

“I dey miss a lot of tins about my sister. I miss how we dey quarrel a lot, how we dey fight, how we dey comot togeda, how she dey make sure say I dey okay, how she dey plan our birthdays becos na only her dey plan our birthday, I no dey really like to plan tins or go out.”

Even though na school bin separate di two sisters dem bin still dey close.

“I bin no really meet her physically wen she bin return from Asaba becos I bin dey school, so physical meet-up bin no dey between me and my sister, but I know say she don change becos her emotions and evritin bin dey different wen I bin dey tok to her on phone.

“I be veri quiet pesin, I no dey like to tok, I no dey like to speak out. She make me learn how to speak up for mysef, I dey make sure say nobody intimidate me.”

Faith tell BBC News Pidgin for interview say she bin ask her sister wia she dey go and who she dey go see, but di sister bin no gree tell her.

“She bin tell me say she dey go Asaba and I bin ask her, who you dey go meet for Asaba? Why you dey go Asaba? I bin ask her dis two questions but she no gree tell me why she dey go Asaba or di pesin she dey go meet for Asaba.”

Wetin we call dis foto, Di grave of late Favour Agbro wey kpai hersef sake of alledged rape by content createor Ifeanyi Ogbonna wey dey popular as Odogwu-Asaba

She add say may pipo for social media dey tink say di tori na lie, as she confan say true-true her sister don kpai.

“Plenti comments and video dey fly upandan for social media about wetin dey happun, some dey tok say wetin dey happun ma content, no be content, no be fake, e dey real.

Dis mata no start dis month, na last month June, 2026, e bin delay becos of di petition wey we bin write to di Commissioner of Police and dem bin no approve am on time, na why e delay till dis month.” She conclude.

Favor report to one activist wey remove hand from di mata

Wia dis foto come from,Comrade Israel Joe

Wetin we call dis foto, Foto of Comrade Israel Joe, di activist wey bring dis mata to light

Comrade Israel Joe tell BBC News Pidgin for interbiew how im take hear about di mata.

“Dem report dis mata give me for di last week of June, like almost one week afta dem don bury Favour.

Bifor she comot from Asaba, she bin report to one human right activist, di activist fear becos di suspect na influential pesin for Asaba. Di activist comot hand for di mata, na all dis tins join wetin make her slide into depression, unto say, so nobody ready to fight for her.

Comrade Israel Joe use di opportunity to advice young girls to shine dia eyes well-well, especially for dis internet and technology era wey pipo dey try to benefit from social media monetisation and content creation by all means.

“As an activist, I go advise a lot of teenagers and of course young pipo make dem take dis social media mata small-small, weda content monetisation or whateva, make dem take am small-small.

Social media dey influence a lot of tins positively and negatively but di negative influence of social media for dis present era for dis our generation, e out-weigh di positive influence. We must make sure say dis Odogwu-Asaba face justice” im conclude.

Tori be say di Delta State Commissioner of Police don transfer di case to di Criminal Investigation Department make dem chook eye for di mata well-well.

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version