Wia dis foto come from,Ministers/X
Published7 May 2026
New Informate 8 May 2026
Read am in 9 mins
South Africa govment don begin review dia immigration policy to address di mata of illegal migration plus allegations of xenophobic attacks on black foreigners
Di govment announce dis informate as response to Ghana request for di African Union to chook mouth for di waves of attacks on foreigners, wey dem describe as xenophobia
South Africa Minister of International Relations Ronald Lamola for statement on Friday, 8 May tok say dem find Ghana decision to escalate concerns about irregular migration to di African Union “regrettable”
Di Southern Africa govment add say: “If AU deem am appropriate to place di mata on di agenda, dem go also propose one agenda item on di push and pull factors of migration, wey include good governance, rule of law, and democracy, in accordance wit di Constitutive Act of di AU.”
Earlier, Ghana Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa bin write to di AU say make dem include di mata of xenophobic attacks for South Africa inside dia agenda for di eight mid-year coordination meeting of di African Union wey go happun from 24 – 27 June 2026
Skip content and continue reading
- Join BBC News Pidgin WhatsApp Channel to stay up to date wit di latest tori dem for Nigeria and around di world
- Ghana authorities relocate citizen wey face harassment for South Africa, prepare to remove odas as anti-immigration protest continue6th May 2026
- US go revoke passports of parents wey dey owe child support – who go dey affected?8th May 2026
Inside one statement, di minister say “di topic of xenophobic attacks for South Africa be mata of concern wey lead to loss of lives and properties in recent years.”
For di statement, di minister say since di tori of acts of intimidations and confrontations against citizens of oda African kontris wey dey live for di kontri begin spread, President Cyril Ramaphosa don condemn am, and im don get serious tok-tok wit di authorities of different African kontris to assure dem say di mata dey receive relevant attention from di govment
“Minister Lamola don engage wit di govment of Ghana and Nigeria and don reaffirm South Africa commitment to protect di rights of nationals, residents and visitors, in line wit di rule of law, and to strengthen bilateral cooperation.”
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
Dozens die for Saudi Arabia and France air crash
Security on high alert ahead of 30 June anti-immigration protest – Police tok- France react as Burkina Faso cut diplomatic relations wit di kontri
Anti-migrant protesters say June 30 deadline for migrants to comot for South Africa still stand
Di Minister of International Relations also say di Southern African kontri don develop one White Paper on Migration to address dia migration problem
E explain say through di White Paper, di kontri go align wit international best practices
Di South Africa govment claim say di kontri na home to approximately three million migrants, and 90 percent of dem na from African continent, wey make South Africa di largest host of African immigrants for di world
Di minister also clear am say sake of big heart wey dem take dey receive foreigners for di kontri, e don put pressure on some of dia infrastructures and cause economic anxieties around unemployment, and service delivery, wey contribute to period tensions between some locals and foreign nationals most of whom lack legal immigration status, wey don lead to tension
We no get refugees camps for asylum seekers as e dey for oda kontris, e add
To address dis migration challenges, Minister Lamola tok say di govment dey in di process of improving di state capacity to manage immigration through a number of interventions
Dis interventions include:
- Economic Protection: Just like Ghana GIPC Act reserve certain sectors for dia own citizens, South Africa don introduce points-based visa system to ensure migration support national development.
- Compliance and Sovereignty: Di Intelligent Population Register go guarantee say entry dey legal, documented, and merit-based, safeguarding both dignity and national security.
- Shared Responsibility: By adopting di “First Safe Country” principle, South Africa don call for regional system of refugee protection wia compassion dey matched by administrative capacity, wey go ensure say dignity dey for dose wey dey in need witout overwhelming any single state.
- Border Management Authority: Since April 2023, di Border Management Authority (BMA) don deport 500,000 pipo.
South Africa call viral xenophobic attacks videos fake
Wia dis foto come from,IHSAAN HAFFEJEE/ANADOLU VIA
South Africa condemn di viral circulation of videos and images wey show attacks on foreign nationals for di kontri. Dem call am fake
During media briefing, cabinet meeting Minister for di South Africa, Khumbudzo Tshavheni say ‘di fake videos and images no only dey fake, but dey intended to spoil di good reputation of South Africa internationally and scata di kontri pursuit of beta Africa agenda”
Dis reaction na afta fotos and videos show wia thousands of South Africans come out to protest against illegal immigration for major cities in recent days
Dem demand di mass deportation of undocumented foreign nationals from South Africa wit accuse say illegal immigration impact on jobs, housing and crime
Di cabinet minister say South Africans dey within dia right to protest against “di spiralling illegal immigration challenge and say violence linked to di protest for di past dey unacceptable”
Sake of di recent attacks on foreigners for South Africa, Ghana govment formally write to di African Union to request say alleged xenophobic attacks targeted at Africans dey placed on di agenda
Di South African govment respond say no xenophobia take place for di kontri, say dem no get anytin to hide but dem go engage if di African Union bring up di mata
Ghana write to African Union ova alleged xenophobic attacks for South Africa
Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY
Govment of Ghana take more action to try to raise di issue of attacks and harassment against African nationals for south Africa
Days afta di kontri relocate one man inside viral video wey anti-migrant protesters bin dey harass for im shop for Diepkloof, near Soweto, Johannesburg, di govment petition di Africa Union (AU) to chook mouth for di wave of attacks on foreigners wey dem describe as xenophobia
Anti-illegal immigration protest groups and oda vigilante societies deny say wetin dey happun now be xenophobia, but say dem dey campaign against undocumented foreigners who dey collect dia jobs
Dem accuse local authorities of neglect as South African citizens continue dey struggle wit unemployment
For Mthatha, Pretoria, Durban and Johannesburg, hundreds of young pipo bin dey protest for more dan one week to demand action against di illegal migrants
Some kontris don condemn attacks on Africans including Nigeria and Mozambique
Di United Nations (UN) also chook mouth wey dem demand say make South Africa authorities deal wit di rising cases of attacks
‘Di AU gatz discuss di mata for dia coordination meeting for June’ – Samuel Okudzeto Ablakwa
Ghana Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa bin write to di AU say make dem include di mata of xenophobic attacks for South Africa inside dia agenda for di eight mid-year coordination meeting of di African Union wey go happun from 24–27 June 2026
Inside one statement, di minister say “di topic of xenophobic attacks for South Africa be mata of concern wey lead to loss of lives and properties in recent years.”
Ghana govment say di development
- Be clear violation of di African Charter on Human and Peoples’ Rights wey South African don sign up to
- E dey undermine di spirit of integration and Pan-Africanism
- E dey against di objectives of di African Continental Free Trade Area (AfCFTA) wey dey promote free movement, reduce barriers and foster common market wey go benefit all Africans.
Di kontri now ask di chairperson for di African Union commission say make im consider some measures for di proposed African Union tok-tok wey go happun for di mid-year coordination meeting for El Alamein for Egypt
- Make dem carry di xenophobia attack mata put for di agenda wit di rules of procedure
- Make di AU increase dia monitoring to support member states to respect dia obligations under di constitutive act of di AU and di Charter on Human and Peoples’ Rights
- Make dem create fact-finding mission to chook eye inside di mata wey dey cause di xenophobic violence for South Africa wey dem gatz recommend appropriate measures to di AU
- Make dem begin dialogue and reconciliation wey go promote tolerance, inclusion, integration and unity among African pipo
Wia dis foto come from,IHSAAN HAFFEJEE/ANADOLU VIA
Di foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa confam say Ghana bin dey ask dem to consider dis mata as serious tin wey dey affect relationships among members of kontris for Africa
“Ghana believe say despite di painful legacy of slavery, colonialism and apartheid, di future of Africa be one wey get shared dignity, prosperity and mutual respect. We gatz ensure say no African dey dehumanised on top African soil.”
Meanwhile, Nigeria and Ghana don begin steps to repatriate dia citizens for South Africa wey dey face threats and harassment back to dia kontris
About 150 Nigerians for South Africa already don show interest to comot di kontri as anti-illegal migrant protests across cities for di kontri dey continue
Nigerian man tok wetin im eye see as protests dey continue
South Africa don record several xenophobic attacks against foreigners wia angry youths bin loot and burn shops wey belong to African migrants for some cities
For 2019, di attacks even lead to death of some African nationals, na so Zimbabwe, Mozambique, Rwanda, Zambia and Sierra Leone condemn di development wey dem describe am as ‘barbaric’ at dat time
Till date, African nationals for di kontri still dey suffer attacks, harassment and bullying for public places, schools and even workplaces
One Nigerian-South African man Peter Odike wey don dey live for South Africa for more dan 20 years tell BBC say im children dey face bully for school from locals
“So, pipo dey fear, I get three kids, and dem dey bully dem for school. Na me dey even dey comfort dem.”
Peter, wey don dey naturalised for South Africa since 2006, tok say many migrants including im family members dey fear for dia lives
Di papa of three, wey marry South African woman, dey operate one small shop for Johannesburg, wia e dey sell shoes
E say businesses owned by foreigners don dey close down sake of dis attacks
Peter tok say even police dey harass migrants for South Africa evri day despite say dem get dia legal documents
“Business dey go down, e no dey safe to stay here,” Peter tok
Peter add: “Police dey harass pipo evri day, even wen you get document na problem wit your face. Once you no look like South African na problem for you
“Some pipo, even wen you show dem paper dem go ask you, ‘Why you dey here?’ You gatz go back.'”
South Africa govment say security agencies dey investigate di attacks but maintain say di kontri no dey xenophobic
Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY
South African govment initially condemn di attacks on African migrants inside viral videos
Dem ask dia citizens say make dem no attack foreigners during dia protests but maintain say dia kontri no dey xenophobic
Presidential tok-tok pesin Vincent Magwenya say President Cyril Ramaphosa bin dey expect di law enforcement agencies to take action against violent protesters
Oga Magwenya for one media briefing on Wednesday, 6 May tok say di South African president bin discuss di mata wit Mozambique President Daniel Chapo wen im visit South Africa
“Both presidents bin agree say South Africans no dey xenophobic, wetin dey happun na pockets of protest, wey dey legal according to our constitution.”
“Di reality of immigration also bin dey, not only for South Africa but throughout di world. Wetin dey important na to respect di rights of evribodi wey dey within our borders wey di protesters gatz protest witout harming anybodi,” Magwenya explain
Im also add say both presidents agree say “African kontris gatz work togeda to deal wit issues wey dey cause plenti migration across di continent”
