Ogbonge TV presenter dey among di 12 pipo Egypt sentence to death for drugs case

Wia dis foto come from,Sarah Khalifa Instagram account

Wetin we call dis foto, Sarah Khalifa na popular TV show host for Mission Impossible, wey dey deal wit crime issues.
    • Author,Paulin Kola
    • Author,Youssef Taha
  • Published9 hours wey don pass
  • Read am in 3 mins

Court don sentence Egyptian television presenter Sarah Khalifa and 11 oda pipo to death by hanging afta court find dem guilty of drug charges.

According to di state-owned al-Ahram newspaper, dem dey among one criminal gang wey dey import ingredients to make drugs wit di plan to sell dem.

Dem also get illegal guns and ammunitions.

39-year-old Khalifa, na popular TV show host for Mission Impossible, wey dey deal wit crime issues. She don deny di charges.

Skip content and continue reading

Dem don sentence nine oda pipo wey dey face trial to life imprisonment, while dem free seven.

Khalifa lawyer tok say she go appeal di death sentence.

Dem announce di verdict last month. However, na afta one month dem confam say di court don go obtain religious opinion from di grand mufti of Egypt – legal requirement for death sentence cases.

During di trial, di court hear say authorities don seize ova 750kg (1,653lbs) of narcotics and di materials wey dem import to make di drugs.

Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading


  • Dominican Republic Joheirry Mola win Miss World 2026 beauty pageant

  • March and March protesters clash wit foreign nationals for South <a href="https://absafricatv.com/africa-map-wetin-different-world-maps-get-right-and-wetin-dem-get-wrong/” title=”Africa map: Wetin different world maps get right – and wetin dem get wrong”>Africa, pipo injure

  • Wetin be Nigeria relationship wit Niger as Tinubu govment deny say dem back failed coup

  • Wetin dey ginger men to get penis fillers and wetin be di risk?

Twenty witnesses don give dia statements to di prosecutors, al-Ahram tok, including di electronic evidence wey include conversations and video clips.

According to di state -run Akhbar al-Youm newspaper wen di judge ask about di about her alledged role during her court last September, Khalifa tok say she neva see any drugs until dem take her foto her wit dem inside di anti-narcotics authority offices.

According to one 2025 Amnesty International report, dem issues 492 death sentences in di whole of last year, but carry out 23 of dem.

Dem find di defendants guilty of drug trafficking and rape, “crimes wey no amount to ‘intentional killing’ dem must limit di use of death penalty under international law and standards,” di report tok.

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version