Police arrest 19 suspects afta latest protest against illegal migrants for South Africa
Wia dis foto come from,RAJESH JANTILAL / AFP
Published5 hours wey don pass
Read am in 4 mins
Police for South Africa arrest fifteen suspects on Friday night sake of violent protests for di city of Durban and surrounding suburb.
According to di police for statement for dia social media handle, di total number of suspects wey dem don arrest now na 19 wey include four suspects wey dem bin arrest on Thursday for attempted murder and discharging firearm for public.
Dis na afta protesters bin allegedly attack foreign nationals sake of kasala wey happun for di junction of Anton Lembede and Dr Yusuf Dadoo Streets for Durban.
Dem burn two houses for di Umbilo area and plenti shops bin dey damaged within and around Durban, and dem still tiff from few of di damaged shops.
Tori be say di protesters bin dey accuse foreign nationals say dem carry firearms.
Skip content and continue reading
- South Africa pause applications from asylum seekers wey be undocumented migrants afta violent protests9th October 2026
- South Africa anti-migrant group protest against gender-based violence and illegal migration30th September 2026
- South Africa issue deadline to end green ID booklet wey go address illegal immigration2nd October 2026
Police say most of di pipo wey dia intelligence officers arrest na students.
“Majority of di arrested suspects na students and intelligence officers togeda wit detectives dey continue di search of di pipo wey dey responsible for di burning of vehicles and buildings. Di suspects go appear for court soon.”
Police add say di suspects go face charges of public violence and malicious damage to property, wit di possibility of oda charges.
Wia dis foto come from,MARCO LONGARI / AFP
Wetin really happun
Kasala bin burst for di junction of Anton Lembede and Dr Yusuf Dadoo Streets for Durban sake of protesters wey dey accuse foreigners say dem allegedly get firearms.
Officers bin struggle to contain di situation as protesters waka through different routes across di Durban Central Business District.
Meanwhile, di KwaZulu-Natal Premier Thami Ntuli say im bin don request make dem deploy army to help reduce di kasala wey don spread evriwia.
Im tok say di deployment dey necessary to restore law and order for di city.
On Friday, protesters bin continue dia protests against undocumented immigration, dem loot small businesses and destroy property for di protest wey enta di second c day of violence back to back for di city centre.
Ntuli say di law enforcement agencies don dey reinforced, but as di violence dey increase im beliv say di deployment of di army dey necessary.
SABC News quote Ntuli wia e tok say “In fact, I don already tok to di police minister to say di situation na di one wey dem gatz deploy army to di province of KwaZulu-Natal. I tink dem dey process my request becos I bin don already request for di army to dey deployed. Well, we go engage di leaders wey dey involved, but at di same time, dem go deploy more police for di province, and some go come from outside to assist. Na wetin dey dey happun underground, and we dey activate am to make sure say we calm di situation.”
Ntuli bin also warn against di continuous protest action wey fit threaten important foreign investment and job creation across di province.
Since dis protest start for South Africa some foreigners no sabi wetin peace be again sake of say dem dey live and fear and protesters dey allegedly loot dia shops and spoil dia businesses.

