
Wia dis foto come from,Brenton Geach/Gallo Images
Published4 hours wey don pass
Read am in 4 mins
South Africa Police say dem welcome di conviction and sentencing of two ‘undocumented foreign nationals’ sake of say dem damage infrastructures for di kontri.
Di police say di illegal foreign nationals chop six years in prison and anoda three months sake of say dem dey for South Africa illegally.
Police say di offence of di two undocumented foreign nationals na say dem “tamper wit and damage essential infrastructure at Three Sisters’.
South Africa announce dis late Friday night as dem say dem go bring more offenders to justice.
Afta dem serve dia prison sentence, police dem go come hand ova di foreign nationals to di Home Affairs Department so dem go deport dem.
“Di court also order say upon completion of dia respective sentences, both accused go dey handed ova to di Department of Home Affairs, Immigration Services, for deportation to dia respective countries of citizenship,” police say.
For anoda operation, South Africa say dem gbab four foreign nations wey dey engage in illicit clothing business.
Meanwhile anoda big protest don ginger for South Africa as March March group issue September deadline to undocumented migrants for di kontri.
Skip content and continue reading
- ‘We neva receive any request’ – Nigeria react to South Africa request for pay back ova repatriated citizens12th August 2026
- ‘Nigerian nationals don lose dia life, South Africa dey use xenophobia as distraction’ – Wetin Nigeria and Ghana tok so far30th July 2026
- Anti-immigration Police operations and death of Nigerian for South Africa cause gbege27th July 2026
Two Ethiopians, one Senegalese in police custody
South Africa for anoda statement say dem arrest three male foreign nationals arrested in connection wit ‘possession and dealing in illicit clothing.
Di police di three suspects violate Counterfeit Goods Act 37 of 1997 and dem appear bifor di Magistrate court on Thursday, 20 August, 2026.
“Two Ethiopian nationals togeda wit Senegalese national, dey remanded in police custody for further investigation and bail application.”
Dem say anoda Ethiopian national wey dem arrest sake of attempt to bribe police officers, don get bail and dem go kontinue dia case for Monday 24 August, 2026.
South Africa police say di four suspects chop arrest during dia operation wey dey focus of counterfeit goods for Musina area of di kontri.
Dem say dis pipo dey do illegal clothing business.
“Police seize counterfeit goods worth thousands of rands, along wit substantial amount of cash used in di attempted bribe,” SA police say.
’13 undocumented foreign nationals arrested’
On Thursday 20 August 2026, team of police under di name Operation Basadi, say dia operation lead to di arrest of 13 foreign nationals wey no dey documented.
“Di operation focus on roadblock on di N4 Road near di Nkomazi Toll Plaza. Di operation further zoomed into di tracing of wanted suspects, raiding of shops wey dey suspected to dey trade in counterfeit and illicit goods,” police say.
“Thirteen undocumented foreign nationals chop arrested for di roadblock,” police add.
During di operation, South Africa dem seize about total of 438 items of illicit and counterfeit goods wey include cosmetics, cell phone accessories, watches, toys and cigarettes.
For July 2026, South Africa police bin announce di arrest of ova 1,200 suspects including 159 undocumented foreign nationals wey dem say go against di immigration act.
South Africa police say dem pack di undocumented foreign nationals for Gauteng province of South Africa during dia operation shanela.
South Africa anti-immigration group give anoda deadline for illegal immigrants to leave
Anti-immigration group for South Africa March and March don give anoda deadline for dia govment to sack all illegal foreigners.
Dis dey happun two months afta dia 30 June deadline for foreigners to comot for dia kontri sake of dem say di foreigners don collect dia jobs, dia women and dia businesses.
Di March and March group wey bin dey lead dis protests since early April bin threaten dia own govment ova di way dem dey handle di illegal immigration wahala.
For di 30 June nationwide protests, di group togeda wit oda vigilantes march across di streets.
Dem ask foreigners wey bin dey occupy some buildings to comot, wey dem warn say dem go continue to protest evri Thursday until dia govment fix di immigration kasala.
Di March and March movement don announce 30 September as di fresh deadline for undocumented foreigners to comot for di kontri.
Dem say dem go repeat di 30 June nationwide protest – dis time, di theme na for Africa kontri leaders to “fetch dia pipo”.
Skip X postAllow X content?
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

