Nigerians mourn death of gospel singer Toluwanisings

Wia dis foto come from,@toluwanisings/Instagram

Published14 October 2026
New Informate 4 hours wey don pass
Read am in 5 mins

Di death of ogbonge Nigerian gospel singer Olayemi Bolaji wey pipo sabi well-well as Toluwanisings don throw many Nigerians, especially im colleagues and fans into mourning.

Many of im fans bin take to social media to express dia condolence afta im family announce im passing late Wednesday night.

Di death of di popular singer bin come as a rude shock to many, as some pipo tok say e still minister for events recently and e look healthy.

Although di family no mention di cause of Toluwanisings death for di statement dem release to comfam in death on Wednesday 14, October, tori, say e slump for im house for Ibadan, di Oyo State capital, and dem rush am go several hospitals wia dem reject am until e later kpai.

Im family for Instagram say; “Wit deep sorrow, di family announce di passing of Minister Olayemi Bayonile Bolaji wey die for di early hours of 14 October 2026.

“A dearly loved husband, family member, and gospel minister. Please keep im wife, family, and loved ones for your prayers during dis difficult time.

“Funeral arrangement go dey announced by di family in due course,” di statement tok.

Skip content and continue reading

  • All you need to know about new Suicide (Prevention) Bill Nigeria senate dey consider14th October 2026
  • Suspected scammers for Nigeria, Ghana chop arrest for joint operation across <a href="https://absafricatv.com/meta-removes-3-7-million-accounts-in-west-africa-scam-crackdown/" title="Meta removes 3.7 million accounts in West Africa scam crackdown”>West Africa14th October 2026
  • Nigeria demand answers as anoda citizen kpai for police custody for South Africa14th October 2026

Celebrities, fans mourn Toluwasings

Many Nigerian celebrities react to di news of im death wit shock, while some extend dia condolence to di relatives of di singer.

One gospel singer, Pelumi Deborah, wey dey wit am three days bifor im death tok share dia last moments togeda.

She express her pain inside one condolence message wey she write wia she tok say her heart still dey struggle to accept di death of di late singer.

“Three days ago, we laugh. Today, you be memory. Unfinished conversation, we no tok goodbye, and my heart dey struggle to understand how quickly ‘see you later’ fit become ‘rest in peace,'” she tok.

“Life dey fragile! Oh, so painfully fragile. Till we meet again, Egbon T.”

Actress Funke Akindele describe di singer as humble and hardworking gentle man.

“Hmmmmm such humble and hard working gentle man. May im soul rest in peace. may di lord comfort im loved ones,” she tok.

Anoda actress Wumi Toriola, on X, tok say di news of im death na “hard pill to swallow.”

“Toluwanisings….. May your soul rest in peace dis na very very hard pill to swallow,” she tok.

Gospel singer Bidemi Olaoba on top Instagram mourn di deathof im friend.

Di singer tok say despite di pain and unanswered questions, e believe say God still dey faithful.

“Lord, we judge you faithful, even in moments like dis wen words fail us and our hearts dey heavy. Lord, we still judge You faithful,” e tok.

Adeyinka Alaseyori ontop her Instagram express her pain as she call God faithful.

“Even for our pain, Lord we judge you say you dey faithful.”

Actress Jaiye Kuti share video of wia she dey sing Toluwanisings’ songs. She pray make di late singer soul rest in peace.

Reports of Toluwanisings death begin trend afta Nigerian lawyer Pelumi Olajengbesi post dis on im Instagram page wit di handle @pelumi.olajengbesi: “My God! What a life! No, Lord! We plead for Your mercy upon Toluwanisings.

“I dey deeply troubled by di deaths of young men and women. Dis no be God’s plan for us. We say no to untimely death!”

Afta Olajengbesi post, Nigerian comedian and gospel entertainer Ayo Ajewole aka Woli Agba say make pipo neva conclude and say dem still dey trust God.

“Please hold on. Please no conclude. We dey trust God,” Woli Agba write for im Instagram page wit di handle @woliagba_ayoajewole.

Many pipo begin pray say make di news of Toluwanisings death be fake tori bifor im family kon confam am

Afta di official announcement, tributes begin pour in for di gospel minister wey many pipo say bin dey hardworking.

Dis dey come two years afta di death of anoda gospel singer Aduke Ajayi aka Aduke Gold wey die for University College Hospital (UCH) Ibadan for August 2024.

Dem bury Aduke Gold for Ikorodu area of Lagos on Friday, 23 August 2024.

Who be Toluwanisings?

Toluwanisings na Nigerian gospel singer, songwriter and music minister wey im real name na Olayemi Bayonile Bolaji.

E dey popular for im energetic praise songs, Yoruba-inspired gospel music and contemporary worship recordings.

Im music dey combine indigenous Nigerian gospel music wit contemporary sounds and make am popular among gospel music audiences on streaming platforms and social media.

For July 2026, Toluwanisings and members of im music crew bin survive accident wey involve dia bus and one fully loaded trailer as dem dey return from one gospel ministration.

E give informate about di incident for one Instagram post and upload di foto wey show dia damaged bus.

“And we survive wetin fit don claim our lives. My Israel no go die for di hands of Pharaoh LAYELAYE. Wen di enemy come like a flood, di spirit of di lord raise a standard against dem!

“Dis na how my team and I fit don dey totally crushed by a fully loaded trailer on our way from one ministration dis morning,” e write for Instagram.

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version