Wia dis foto come from,National Commission for Refugees, Migrants and Internally Displaced Persons
Published26 August 2026
New Informate 2 hours wey don pass
Read am in 4 mins
Sixty-seven Nigerians don return from South Africa under one privately funded repatriation programme, Nigerian officials tok.
Di group arrive for Murtala Muhammed International Airport for Lagos for di evening of Wednesday, 26 August, through one South African Airways flight and na officials of di National Emergency Management Agency (Nema) and di National Commission for Refugees, Migrants and Internally Displaced Persons (NCFRMI), receive dem.
According to di NCFRMI, di returnees na 30 adults, 36 children and one infant.
Dis dey come just about one week afta anoda 83 pipo bin also come back to Nigeria from South Africa on 18 August.
Skip content and continue reading
- Why Trump administration wan cancel B1, B2 visas of 200,000 asylum seekers and increase H-1B visa fee to ova $103,00026th August 2026
- America country music legend Dolly Parton don die at di age of 8025th August 2026
- Tinubu order manhunt as survivors claim gunmen kidnap ova 500 pipo from villages for Niger state25th August 2026
Di pressure continue to dey mount from anti-immigration protesters for South Africa wey call demsefs di ‘March and March’ group.
Dem don set anoda deadline of 30 September wen dem tok say evri illegal migrants for South Africa must to pack im load and leave di kontri.
For months now, di March and March group don intensify dia anti-immigration campaign, as dem claim say di govment of South Africa no wan tackle di high rate of immigrants wey dey enta di kontri illegally.
Dem bin first give deadline of June 30 for citizens of African kontris to comot from dia kontri, and true true, more dan 85,000 pipo from Nigeria, Ghana, Malawi, Zimbabwe, Zambia and odas, run comot from South Africa bifor dat date.
Govments arrange emergency flights to comot dia citizens and kontris wey get land border wit South Africa, like Mozambique, Zimbabwe, and Malawi, arrange for buses to carry dia pipo.
Di March and March group claim say na sake of illegal immigration make di kontri economy dey bad, youth unemployment dey increase, and also drug and violent crimes dey on di rise.
Dem claim say dem no get problem wit pipo wey dia immigrant status for South Africa dey legal, but some Nigerian and Ghanaian returnees don tell di BBC say dia status bin dey legal wen dem dey for South Africa, yet di protesters target dem.
Homes and businesses of many African citizens don also dey targeted by protesters wey use di opportunity to loot and destroy pipo livelihoods.
One Nigerian returnee narrate to Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) how dem bin harass and rob her plenty times wit gun wey dem point to her head
Di South African govment say dem donmake plenty arrests and dey prosecute pipo wey break di law during di anti-immigration protests, and say dem don warn dia citizens make dem no dey take di law into dia own hands.
Meanwhile, some African govments including Nigeria and Ghana dey demand for compensation from South Africa for many of dia citizens wey lose diaration protests, and for di many wey gatz abandon dia properties for di kontri as dem run for dia lives
South Africa govment, on di oda hand, say dem go demand make govments pay dem back di money wey dem spend to deport dia citizens from di kontri. But Nigeria govment say dem neva receive any request like dat.
Fotos of di returnees
