ADC Vice-Presidential candidate Rotimi Amaechi allege plan by EFCC to arrest am before 2027 election
Wia dis foto come from,Rotimi Amaechi/X
Published16 November 2026
Read am in 4 mins
Di African Democratic Congress (ADC) Vice Presidential candidate for Nigeria 2027 elections Rotimi Amaechi don allege say di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC dey plan to arrest am bifor di kontri 2027 general elections.
Inside exclusive interview wit BBC News Pidgin, di former minister and Rivers State Govnor allege say di plan na to further cause kasala and stop dia party for di election.
We ask EFCC for comments, dem neva respond.
“Make dem come, I dey here dey wait for dem. No be carry dem go carry me? Na just to make sure say we no defeat dem.” Na so di vice presidential candidate tok wen we press am to tok more about di alleged plan.
Im comment dey come as di party dey in di middle of one legal battle wey fit stop dem from participating in di 2027 elections.
On November 5, 2026, di Federal High Court Justice Peter Lifu deliver one judgment wey cancel di David Mark-led leadership of di ADC and void all actions wey im caretaker committee bin take, including di presidential primary wey produce Atiku Abubakar as di party 2027 flagbearer.
ADC don vow to appeal di case.
Skip content and continue reading
- Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
- Tinubu issue warning order ova attacks at political rally15th November 2026
- Who be Faisal Maina wey court sentence to seven years in prison13th November 2026
‘Di initial goal na to be Nigeria president but for now, I support Atiku’
Inside di exclusive interview wit BBC Pidgin, Amaechi also touch on im party candidates and dia chance for di upcoming elections,
Amaechi bin contest di primaries of di All Progressives Congress, APC, for presidential ticket for 2022 but e lose to di current President, Bola Tinubu. Same tin wit di ADC dis year, e lose di ticket to di former Vice President Atiku.
E say e bin no gree to to run wit Atiku, but afta some counsel e see reason.
“I bin no gree, but wen elders tok to me say no be about me but about Nigeria. Atiku dey run becos of Nigeria, you dey run becos of Nigeria, if Atiku win, allow am just follow am, e don tell you say e wan run wit you, follow am, go run wit am make we rescue Nigeria first, becos if dis man come back, e go worse pass”
“If Atiku dey govern well why I go wan be president? Why? Afta Atiku den we go fit discuss am. Make we focus on Atiku’s presidency, di moment e dey govern well, all of us go dey clap for am if you run against am you go lose. ” E tok.
As to wetin e bring to di table wey go give Atiku and im party a chance to win, e say dem go bring back fuel subsidy and implement production subsidy’.
“We go bring fuel subsidy back. No be di one wey dem dey tiff money under di past goment. If you get refinery for Nigeria, we go give you subsidy. If for instance, dem dey sell crude oil for oyibo land $15,000 for instance, di pipo wey dey produce oil here, we go sell am for $10,000.
Di difference wey dey between di two, $5,000 na im be di subsidy. Wetin e go do be say di price of everytin go come down, price of fuel, transport, housing, everytin.”
Wen we ask am if e bin support say make subsidy remain during di last administration wia e bin minister, e say ‘No’ and e tok why.
“Dat time, income to manage dis kontri bin dey difficult, some of us bin tink say to remove fuel subsidy dat time na im be solution, Don’t forget say we no be president becos if you be president economists go tell you wetin dem tink say you fit do.
Atiku bin tok say im go remove subsidy but wen economists tell am say see di consequence, everybodi dey suffer but if you wan solve dis problem wey everybody dey suffer, go for production subsidy.”
On defence from critics say di economy of Nigeria bin don dey spoil come no be today, Amaechi argue say tins bin no dey dis bad and say anybody wey bring imsef forward to lead suppose be say e get solution to problems.
“No time problem no dey for kontri, di reason you put yourself forward na say you say you get solution and if di solution no dey come, mean say you no get solution and you just dey come look for money to put for pocket.”
On im party chance to win especially in di midst of dia ongoing court battle, Amaechi express confidence say pipo want change.
“If na you, you go vote for Tinubu?”
“God dey, I be lawyer I no wan attack di judge but e no do well, e no do well at all. For elementary law say inside party, una dey quarrel, court no dey put hand. Na only wen di quarrel come reach Inec.
Again, make we no judge court or Peter Lifu, make we wait, we believe say di pipo wey dey for Court of Appeal na high pipo. We hope say di Court of Appeal go correct di mistake wey Peter Lifu make.”
