Wia dis foto come from,FANI MAHUNSI/GALLO IMAGES VIA

Wetin we call dis foto, File photo – South Africans dey ask authorities and dia govment to prioritise locals for jobs

Published23 April 2026
Read am in 4 mins

Ghana authorities dey demand investigation for latest wave of attack on Ghanaians and oda foreigners by South African anti-immigration protesters for di kontri

Foreign Affairs minister Samuel Okudzeto Ablakwa tok say im connect wit South African officials about di attacks inside one viral video wey dem dey try to figure how to deal wit di matter

Viral videos capture when groups of South Africans wey describe diaserf as anti-immigration taskforce don dey attack foreigners; dem harass some of dem and even assault odas

About three men bin dey punch di face and head of one Ghanaian during di protest when dem find say im be Ghanaian

One woman wey be di leader of di group tok say “we dey fix dis continent, dis tin wia you pipo go dey move from one kontri to di oda no go work anymore. We dey tired wit African migrants wey dey refuse to fix dia kontris.”

“Now we dey make am clear say we no want you pipo for hia. Make you pipo fix your kontris. You enta South Africa as visitor wey you decide to integrate wit us, we no fit enta Ghana and do wetin you pipo dey do for hia,” di leader of di group tok

Skip content and continue reading

  • Niger, Nigeria and Burkina Faso pipo among undocumented migrants Ghana send back to dia kontris22nd April 2026
  • Court remand suspected coup plotters for DSS custody afta dem plead not guilty22nd April 2026
  • Why OPM General Overseer suspend di marriage of im autistic children23rd April 2026

Inside oda viral videos, some angry South Africans bin dey sack foreigners from one public hospital

“If you no be South African for dis hospital, make you comot dis place now,’ one young man bin tok inside di video when di anti-immigration protesters storm di hospital

Im tok say di South Africa laws no dey allow public hospitals to treat foreigners

Dem begin to inspect di hospital cards of pipo wey dey di facility as di foreigners now begin to comot

“Doctors, make you stabilize di foreigners and discharge dem make dem go private hospital for care, dis no be dia place,” leader of di group tok as im dey roam for di hospital OPD

Wia dis foto come from,FANI MAHUNSI/GALLO IMAGES VIA

Wetin we call dis foto, File photo – Residents of Mthatha dey protest on Thursday against foreigners wey dey take dia jobs

Foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa say im tok wit im counterpart for South Africa Ronald Lamola togeda wit dia minister for international relations about di latest incident

Im describe di viral videos as “extremely disturbing.”

Oga Ablakwa add say “di South Africa foreign minister don express sympathy wit di victims of di attack wey im promise investigation for dis mata.”

“I dey in contact wit Ghana high commissioner Benjamin Quarshie wey don dey coordinate our response for dis mata, wey dem find di Ghanaian victim inside di viral video,” di minister write on top im social media

Oga Okudzeto Ablakwa confam say di victim dey alright wey im dey receive consular assistance

“No Ghanaian die for dis latest attacks. We don dey ask our pipo to remain calm as we work to protect Ghanaians home and abroad.”

On top social media pipo bin dey ask Ghana authorities to act on di mata

Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana foreign minister confam say di govment demand investigation into di viral videos wey show South Africans attacking and assaulting one Ghanaian

Ghana community ask pipo to stay in-doors during anti-foreigner protest

Residents for Mthatha, di Eastern Cape province of South Africa plan to stage more protest on Thursday ova di presence of foreigners

Demonstrators dey ask for jobs for citizens as dem tok say foreigners don collect all dia jobs

Leader for di Ghana community for Mthatha Dr Yirenkyi Gyekye Darko say im tok wit police about di mata wey dem assure dem say di protest go dey peaceful

Dr Yirenkyi tok local mediaCitinewsroom say “police dey take di mata seriously to make sure tins dey under control.”

“We don ask our pipo to stay indoors, make dem no open dia shops until when di situation calm down.”

According to Dr Yirenkyi Gyekye Darko, residents for Mthatha dey demand from di South Africa govment to create jobs for di locals, as dem claim say foreigners including Ghanaians, Nigerians, Zimbabweans and oda nationals bin dey collect dia jobs

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version