Ghana go conduct independent autopsy as bodi of citizen wey dem kpai for <a href="https://absafricatv.com/south-africa-government-urges-united-african-response-to-illegal-migration/" title="South Africa: Government Urges United African Response to Illegal Migration”>South Africa return home

Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Di body of di Ghana citizen wey dem kpai for South Africa for di eve of 30 June nationwide anti-immigration protests don land for di kontri
Published3 hours wey don pass
Read am in 4 mins

Di bodi of 40-year-old Ghana citizen wey dem kill for South Africa on di eve of di 30 June nationwide anti-immigration protests don arrive for di kontri.

Govment officials say di death of Bashiru Isak dey linked to di current wave of xenophobic attacks for South Africa even though police for di rainbow kontri say di death dey related to ‘extortion”.

Inside one statement from Ghana foreign ministry, dem confam say “dem shoot Bashiru wey be law-abiding father of three, multiple times for Khayelitsha, a suburb of Cape Town, contrary to false claims by some South Africa officials”.

“Ghana govment wit di consent of di family of di deceased through di High Commission for Pretoria bin facilitate di repatriation of di bodi to di kontri on 14 July.”

Ghana govment officials togeda wit family members of di deceased bin receive di bodi for di airport wey dem later carry go di 37 Military Hospital for Accra.

Skip content and continue reading

  • Ghana authorities go begin repatriation of ‘final batch’ of 900 citizens from South Africa on 25 July15th July 2026
  • Why Ghana authorities arrest opposition NPP spokesperson Denis ‘Miracles’ Aboagye13th July 2026
  • Ova 300 more Nigerians arrive from South Africa – wat next?15th July 2026

Di death of di 40-year-old bin send shockwaves across di kontri especially as vigilantes and oda groups continue anti-immigration protests wey dem dey harass and attack African nationals for di kontri.

Even though South Africa police say dem bin dey investigate di killing, Ghana officials say dem want justice for dia citizen.

Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Officials from di foreign ministry and family of di deceased 40-year-old receive di bodi for airport

Since anti-immigration protests begin for early April, many African kontris – Ghana, Nigeria, Zimbabwe, Ethiopia, Malawi, Uganda and odas don begin dey repatriate dia citizens wey dey run comot from xenophobic attacks for dia homes and dia workplace.

South Africans bin accuse dis Africans say dem dey responsible for di high rate of unemployment for di kontri wey dem dey involved for criminal activities, allegations wey govment of dis African kontris don deny.

Dem go bury Bashiru afta dem do autopsy for di bodi

Di Ghana govment for dia statement don express condolences to di family of di father of three.

“Di Foreign Ministry bin gree wit di family of di deceased to do independent autopsy especially as attempts by di Ghana High Commission for South Africa to get autopsy report from South African authorities, no dey successful,” di statement explain.

Dem add say “we want justice. We dey expect quick investigation and prosecution of di suspects for dis case, wey dem for neva cova up di killing of Bashiru Isak”.

Di family of di deceased go soon bury dia dead afta di autopsy

“Ghana govment dey committed to pursue all diplomatic avenues to ensure justice.”

Wia dis foto come from,GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Di family of di deceased father of three say dem dey want justice

South Africa police no give any fresh update for dia investigation for dis mata.

But dem tok say dem dey work to deal wit illegal immigration wey dey deport ova 53,000 African nationals since dem begin dia law enforcement.

Ghana meanwhile dey prepare to repatriate di “final batch” of 900 citizens for 25 July.

Authorities say dis 900 pipo already go through di process of registration and screening wey dem go announce to dem di exact time each batch go join di flight to Ghana from 25 July.

Ghana High Commissioner for South Africa, Benjamin Quashie say afta dis ‘final batch’ wey go add to di nearly 1,000 dem already repatriate between late May and early June, any oda repatriation go dey on “case-by-case basis”.

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version