Nigeria evacuate 269 citizens from South Africa as June 30 deadline for illegal migrants to comot take effect

<img src="https://absafricatv.com/wp-content/uploads/2026/06/ee4f5c10-7475-11f1-8e1d-bbbb1017d210.jpg.webp" alt="Nigerians arriving from South Africa“>

Published29 June 2026
New Informate 6 hours wey don pass
Read am in 5 mins

Di third batch of Nigerian citizens wey dey comot from South Africa don land for Murtala Muhammed International Airport, Lagos

Di Ministry of Foreign Affairs say di third evacuation flight from Johannesburg wey Air Peace dey operate land on Tuesday, 30 June, at 10:48am wit 269 returnees

Dis na addition to di 66 returnees wey bin don arrive wit South African Airways facilitated by one Nigerian on 24 June, 2026

According to di tok-tok pesin for di ministry, Kimiebi Imomotimi Ebienfa, di batch of 269 evacuees, wey officials of di Nigerian Mission for South Africa escort come back, bin dey officially received for airport by senior officials of di Ministry of Foreign Affairs led by di Director, African Affairs Department, Ambassador Haruna Ali-Gombe

Ali-Gombe welcome dem on behalf of President Bola Ahmed Tinubu, and reaffirm di federal govment commitment to ensure di safety of Nigerian nationals wey dey live outside di kontri

Skip content and continue reading

Di federal govment emphasise say di evacuation process still dey on course and more flights dey expected for di kontri in di next few days to evacuate all Nigerians wey dem don screen and clear to voluntarily return to di kontri

Citizens of oda African kontris including Ghana, Malawi, Mozambique, and Zimbabwe don also leave South Africa to return to dia home kontris as dem dey fear for dia lives becos of xenophobic attacks

Also, Ugandan govment announce say dem go repatriate dia citizens from South Africa, afta 746 citizens show dia interest to comot from di kontri and return home safely

Ghanaian authorities issue advisory to dia citizens for South Africa

Wia dis foto come from,Samuel Okudzeto Ablakwa/

Ministry of foreign Affairs for Ghana don advise Ghanaians wey wan travel to South Africa make dem dey careful as dem dey plan dia trip due to di anti-migrants campaign wey dey happun for di kontri

Di ministry advise Ghanaians wey wan travel go or wey dey within South Africa make dem dey veri exercise caution until di situation return to normal

Di ministry inside one public advisory ask Ghanaians make dem reconsider non-essential travels to places wia dem dey plan di protests

Di Ghanaian authorities say make dia pipo monitor local news and official announcement from di Ghana High Commission for South Africa

Oda tins wey Ghanaian authorities want dia citizens to do:

  • Make dem avoid all protests, marches, and large gatherings.
  • Stay alert for public places like bus stations, shopping malls, and clubs.
  • Make dem carry all dia travel documents, passports and valid visas.
  • Make dem carry copies of ID separately from di original.
  • Make dem avoid to travel afta night unless e dey important; and tell family or trusted pipo about travel plan so dem go fit maintain communication.

Di Ghanaian authorities also tell dia citizens wey dey for South Africa say:

  • Make dem limit unnecessary movements during dis period.
  • Make dem avoid protest routes and areas wey dey experience unrest.
  • Make dem keep emergency supplies, essential medicine and communication devices available.
  • Make dem ensure say family members fit contact each oda in case anytin happun or dem get emergencies.
  • Report any threats or attacks to South African Police and inform Ghana High Commission.

Di advisory ask Ghanaians wey need emergency consular assistance make dem reach out to Ghana High Commission for Pretoria through dia official emergency numbers and email

Ghana govment don tok say dem dey committed to di safety and well-being of all Ghanaian citizens abroad, and dem dey urge all nationals make dem dey calm, obey law, and dey security conscious always

Ramaphosa call for peace for South Africa

Wia dis foto come from,Ton Molina/Bloomberg

Meanwhile, on Monday, 29 June, ahead of di planned protest, South African President Cyril Ramaphosa call on South Africa citizens make dem use dia constitutional right to protest peacefully, as e warn against violence, intimidation and vigilantism becos dem no go tolerate all dis during di nationwide demonstrations ova illegal immigration

Ramaphosa say di govment dey improve border management, take serious steps against undocumented migration, dey enhance asylum and visa processes, and dey tackle corruption wey dey undermine immigration enforcement

Di president make am clear to di citizens say South Africans get constitutional right for dem to protest, but dem must use dat right responsibly as e dey urge protesters make dem show dia view peacefully, lawfully and wit respect for di rights, dignity and safety of oda pipo

“Dis concerns dey real and e deserve make we hear am,” di president tok

“Wia our systems don fail, we go correct am. Wia corruption don enable illegal immigration, we go hold di pipo wey do am responsible. Wia enforcement no dey adequate, we go improve am,” Ramaphosa tok

Di president say anybodi wey engage in criminal act during di demonstrations go face di law

“We must reject di act of violence or intimidation say e dey justified on di basis of our grievance, for political reasons, or becos some pipo wey dey commit suct act dey claim say dem provoke dem,” e tok

Ramaphosa also stress say immigration enforcement na responsibility of state institutions wey get authority, no be private individuals

E welcome assurance from some protest organisers say dem go keep di protests peaceful

“Dem go stay true to dis promise, becos no mata how legitimate e be, e no go be excuse to shift responsibility for violent act,” Ramaphosa tok

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version