Wia dis foto come from,Ziyaad Douglas/Gallo Images
Published14 May 2026
Read am in 3 mins
South African President Cyril Ramaphosa go face di kontri parliament on Thursday wia e dey expected to come unda fire by opposition members
Dis na di first time oga Ramaphosa go face di lawmakers since one court for di kontri rule say dem suppose set up process to determine weda to impeach di president
Kwesions about di ruling by di Constitutional Court no dey on di list, according South Africa SABC News, but some opposition lawmakers fit try to bring up di matter during follow-up kwesion
Ramaphosa go mostly tok about issues like di ‘Operation Prosper’, wey be military operation to clear communities wia criminal gangs dey disturb and oda places wia pipo dey engage for illegal mining
E go also tok about di procedure e bin follow to suspend di National Police Commissioner, Fannie Masemola, plus wetin govment dey do about di rising unemployment
Di South African president dey face di National Assembly to answer kwesions on important govment policies and actions, at least once evri quarter
Skip content and continue reading
- Court sentence Nigeria former minister of power Saleh Mamman go 75 years imprisonment13th May 2026
- Alexx Ekubo family reveal wetin kpai di actor and wia e die13th May 2026
- South Africa release list of untraceable suppliers wey dey scam customers13th May 2026
On Friday 8 May 2026, di South Africa Constitutional Court bin rule say di National Assembly no do well wen dem vote for December 2022 to dismiss di Section 89 of di independent panel report wey concern Ramaphosa ‘Phala Phala’ scandal
Di ‘Phala Phala’ or ‘Farmgate’ scandal refer to di mata wey one former South African spy boss, Arthur Fraser, bin file wit police, wia e bring accuse say tiff pipo bin attack Ramaphosa farm for Phala Phala in 2020, and tiff about $4m in cash, but di president cover di incident
To hold dat kain amount of money for cash dey illegal for South Africa, but President Ramaphosa, though e agree say di theft bin hapun, e tok say di amount wey dem tif na just about $580,000, wey be moni im bin make from selling one buffalo for im farm
E also deny say e cover up di mata
Afta di ruling on Friday, opposition leaders, including controversial politician Julius Malema of di Economic Freedom Fighters (EFF), call on Ramaphosa to resign
Malema say di President suppose “concentrate on dis impeachment process because e get serious implications on him as an individual.”
But di presidency issue statement to say Ramaphosa no dey fear to subject imsef to due process
Den Ramaphosa imsef tok days later say e no go resign
“I wan make am clear say I no dey resign,” e tok. “To do so go be to abandon di responsibility wey I assume wen I become President of the Republic.”
