Nollywood stars hold special prayers for Ogogo wey dey battle cancer

Published5 hours wey don pass
Read am in 5 mins

Prayers dey go on for ogbonge Nigerian actor and filmmaker Taiwo Hassan wey im family confam say dey battle stage four cancer.

On Friday, 21 August, Nollywood stars and filmmakers for di Yoruba industry bin gada to offer special prayers for di veteran actor, wey pipo sabi well-well as Ogogo, for di middle of im ongoing health challenges.

One video wey popular ogbonge actor Yinka Quadri post wey don go viral, show as plenty prominent Nollywood personalities gada to pray for im recovery.

“Filmmakers come togeda in heartfelt prayers for veteran Actor Alhaji Taiwo Hassan Ogogo, to seek Allah mercy, divine intervention, and complete healing and recovery for am”, Quadri write for di post on Instagram.

Skip Instagram postAllow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

Skip content and continue reading

  • Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
  • ‘I send my children to go farm go harvest rice, but dem die for water’ – Mother of Sokoto boat accident victims21st August 2026
  • You fit get salmonella from eggs? – All you need know about di bacteria wey don make hundreds of pipo sick6 hours wey don pass

Di prayers dey come afta Ogogo daughters bin enta social media to announce say dia papa dey battle cancer and make Nigerians recommend wia e fit get treatment as hospitals don refuse to give am chemotherapy.

Ogogo bin trend on Monday, 17 August and Tuesday afta im daughter Kira Taiwo cry for video wey don dey go viral on social media say im papa bin dey struggle wit stage 4 cancer.

“I no want my papa to die,” dis na some of di words from Kira for di viral video as she say hospitals wey dem carry her papa go, no gree treat am again.

She bin ask di public if dem know anybody or facility wey fit treat her papa to reach out to dem.

“I dey hia to ask for help for my papa, im get cancer and e dey really really bad. Many hospitals no gree treat am, at least, abeg make una give dis man chance.

“Nobody wan do anytin, we no dey ask for money, if you know pesin wey know pesin wey fit treat am, make una help,” she tok.

Following di announcement, plenty pipo don say dem fit heal am as dem offer dia assistance both spiritually and traditionally.

However, one of di leaders for di industry, Jide Kosoko for one statement appeal to fans, colleagues and well-wishers to continue to dey pray for di ogbonge actor, as e give update on Ogogo health.

E say currently Ogogo dey receive treatment for hospital and dem no fit move am to anoda facility despite offers of spiritual and medical assistance.

“We don see and receive many of your messages, prayers, encouragement, and offers of assistance, and we wan say thank you to you all. “We dey deeply grateful to everyone wey don volunteer to assist us spiritually, medically, and in evri oda way possible. We particularly appreciate dos wey don reach out to say dem get spiritual assistance, treatment, or oda means dem believe fit help am.”

Kosoko acknowledge say dem don receive hundreds of offers from pipo wey believe say dem fit heal am, however, dem beg evribody to continue to dey pray for am.

“We believe strongly say wit your prayers, our prayers, and di mercy of Almighty God, Taye go come out of dis situation successfully,” e add.

According to Kira wey break di news of her papa health, di cancer just begin show and na three weeks ago dem diagnose am of di life-threatening disease.

“We bin no even know untill like three weeks ago, so abeg, I dey beg una, if you know pesin wey know anoda pesin wey go fit treat am, we dey ready to try anytin, abeg we no dey hia to ask for money.”

She add say her papa dey suffer from stage four cancer and her big uncle na im dey help wit di hospital bills since dem notice say im get cancer.

Who be Taiwo Hassan?

Taiwo Hassan na Nollywood actor, wey dey popular for im multiple roles for di Yoruba feems.

Im don dey act for veri long time and na face wey pipo wey dey watch feem well-well fit recognise.

Ogogo na 66 years old and na ogbonge actor for Nollywood. Di actor also dey known for im beautiful voice wen e dey chant.

E come from di family of twins. Im forefather na Taiwo, di one wey follow am na Taiwo, im papa na Taiwo and im mama give birth to twins four times.

Ogogo na di last of im parents twins wey kpai. Im parents born thirteen pikin dem wey remain three.

Ogogo na trained boxer wey no dey hide im boxing skills.

Di actor bin battle chronic ulcer for six to seven years wey bin nearly take im life.

Im best friend na Yinka Quadri – e say no friend wey im don eva love like dis fellow actor.

‘Na all of us go chop breakfast’ na famous Ogogo line for one Yoruba movie wey become street slang.

Tori be say im acting career don pass forty years and im don act ova 300 feems for Yoruba. One of di ogbonge feems wey im act and wey blow well-well na Owo Blow wey dem release for 1996 and directed by Tade Ogidan.

Pipo also sabi Ogogo as pesin wey get action inside feems wit di way e dey act, im aura and how e dey carry imsef. Na dis im action create di Yoruba street slang, ‘Action Po bi Ogogo,’ wey mean ‘Action Plenty like Ogogo’.

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version