Burna Boy, Shakira, BTS and odas stars to perform for di World Cup Final half-time show
Publishedone hour wey don pass
Read am in 3 mins
Burna Boy go follow Shakira, K-pop band BTS and Madonna to headline di World Cup Finals dis Sunday.
Di finale wey dey happun between Argentina and Spain go hold for New Jersey, dis go put end to di newly expanded World Cup Format wey United States, Canada and Mexico host.
Di BBC bin hear say di show go last for 11 minutes, even as tori dey say di show fit pass15 minutes wey be di limit wey di game laws dey put on top breaks.
Dis tori dey come bicos for di last Summer Club World Cup final for di US wey happun between Chelsea and Paris St-Germain, dia half-time show bin last ova 24 minutes.
Currently na normal tin for games like di Champions League final to get performances bifor di match. Howeva, dis ho be di first time wey dem go di half time show for World Cup final.
Skip content and continue reading
- Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
- Students die as military crush terrorists plan to kidnap students of Federal Government Girls College Monguno3 hours wey don pass
- How much be di prize money and oda pecks for winners of di Fifa World Cup?18th July 2026
According to tori from dia social media, Columbian pop star Shakira go sing her official World Cup song Dai Dai, wey she sing wit Nigerian star Burna Boy. Dai Dai na Italian phrase wey mean “let’s go” or “come on”.
As for di oda pipo wey go perform for di half time show, di ‘Queen of Pop’ Madonna wey be di best selling female music artiste of all times don drop her 15th album wey she call Confessions II for 3 July.
Meanwhile BTS wey be di best music act for South Korean history go dey di middle of dia 85 date world tour wen dem come to perform for di World Cup.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
- Nigeria govment sama 10 count charges on Orire schoolchildren kidnap suspects
- Students die as military crush terrorists plan to kidnap students of Federal Government Girls College Monguno
- Trump administration tighten visa rules for foreign students
- South Africa anti-immigration leader shot dead, police begin investigation as five suspects impersonating Home Affairs chop arrest
A member of di band, JungKook bicom di first to perform for di World Cup during dia military service hiatus for di Qatar World Cup opening ceremony.
Justin Bieber na anoda pesin wey dey expected to play for di World Cup half time show, afta e bin headline for Coachella dis year.
Dis dey come afta e comot from almost four years hiatus to drop two back-to-back albums wey im call SWAG and SWAG II for 2025.
For March, Fifa president Gianna Infantino tok say, di show “go be historic moment for di Fifa World Cup wey be di biggest sporting event for di world”.
Di pesin wey dey arrange dis show na Chris Martin from di music band Coldplay and e dey happun to get money for di Fifa Global Citizen Education Fund, one initiative wey dey work to raise like $100m (£73m) for children all ova di world.