Close Menu
    Facebook X (Twitter) Instagram
    • Home
    • Contact Us
    • About Us
    • Privacy Policy
    • Terms Of Service
    • Advertisement
    Monday, June 29
    Facebook X (Twitter) Instagram Pinterest Vimeo
    ABS Africa TV
    • Breaking News
    • Trending
    • Africa News
    • World News
    • Features
    • Technology
    • Sports
    • Politics
    • More
      • Culture
      • Lifestyle
      • Travel
      • Business
      • Environment
      • Legal
      • Health
      • Cameroon
      • Ambazonia
      • AfroSingles
      • Environ/Climate
      • Editorial
      • The Leak Magazine
    • Donate
    Subscription
    ABS Africa TV
    Home»Lifestyle»Protests in South Africa against foreigners: ‘I marry South African woman, dem dey bully my kids for school’ – Nigerian man tok wetin im eye see as protests dey continue – BBC News Pidgin
    Lifestyle

    Protests in South Africa against foreigners: ‘I marry South African woman, dem dey bully my kids for school’ – Nigerian man tok wetin im eye see as protests dey continue – BBC News Pidgin

    Jamia NdamukongBy Jamia NdamukongJune 29, 2026No Comments4 Mins Read
    Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Email
    Protests in South Africa against foreigners: ‘I marry South African woman, dem dey bully my kids for school’ – Nigerian man tok wetin im eye see as protests dey continue – BBC News Pidgin
    Share
    Facebook Twitter LinkedIn Pinterest Email
    Post Views: 22
    Foto of Peter Odike, Nigerian citizens wey marry South-African woman.

    Published6 May 2026
    Read am in 5 mins

    Wetin start as anti-migrants protest for South Africa don turn violent as many foreign nationals wit legal status for di kontri don begin fear for dia lives

    According to local reports, many businesses owned by foreign nationals don dey close down, even children from multiple nationalities don dey fear to go school as many dey face bullying from dia peers

    Nigerian-South African Peter Odike wey don dey live for South Africa for more dan 20 years tell BBC say im children dey face bully for school from locals sake of di ongoing xenophobic attacks against foreigners

    “So, pipo dey fear, I get three kids, and dem dey bully dem for school. Na me dey even dey comfort dem.”

    Peter, wey don dey naturalised for South Africa since 2006, tok say many immigrants including im family members dey fear for dia lives

    Skip content and continue reading

    • Nigeria warn citizens for South Africa as fresh anti-foreigners protests dey ginger24th April 2026
    • Ice explain why dem drag out Nigerian man from hospital for New York to arrest am4th May 2026
    • US Department of Justice release names of Nigerians, Ghanaians, odas wey dem convict for $215m scam1st May 2026

    Di papa of three, wey marry South African woman, dey operate one small shop for Johannesburg, wia e dey sell shoes. E say businesses owned by foreigners don dey close down becos of dis attacks

    Peter tok say even police dey harass immigrants for South Africa evri day despite say dem get dia legal documents

    “Business dey go down, e no dey safe to stay here,” Peter tok

    Peter add: “Police dey harass pipo evri day, even wen you get document na problem wit your face. Once you no look like South African na problem for you

    “Some pipo, even wen you show dem paper dem go ask you, ‘Why you dey here?’ You gatz go back.'”

    Anti-migration protest hold for Durban

    Zulu prince and im pipo join di march against illegal immigration for Durban, in South-Africa.

    Thousands of South Africans bin march to di streets of Durban wearing dia different traditional attires wit placards and sticks as dem begin sing and chant to demand for tougher action against illegal immigrants

    As di protest continue, many citizens gada for Mahatma Gandhi Road, wia majority of foreign nationals dey reside for South Africa

    Dis protesters allege say na undocumented foreign nationals dey stay for di area for South Africa and na dem dey sell illegal drugs to young South Africans wey be di major motive behind dia agitation

    Anti-migrant sentiment don gain ground for South Africa as many locals believe say foreigners dey take dia jobs and dem dey benefit from public re

    Meanwhile, President Cyril Ramaphosa don ask South Africans make dem no allow hatred grow towards “fellow Africans”

    African kontris react to di xenophobic attacks for South Africa

    Foto of Nigeria Minister of Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukwu during one press briefing for Abuja.

    Wia dis foto come from,Bianca Odumegwu-Ojukwu/X

    Wetin we call dis foto, Bianca Odumegwu-Ojukwu na Nigeria Minister of Foreign Affairs

    Di Nigerian, Ghanaian and Kenyan govments don tell dia citizens wey dey live for South Africa to dey cautious and stay safe from di impounding pressure against foreign black immigrants

    On Monday, Nigerian govment bin call for investigation into di deaths of two Nigerians wey die for South Africa and demand for di prosecution of dia killers

    Di govment bin announce di deaths of Kelvin Chidiebere Amaramuiro and Ekpenyong Andrew wey die for South Africa becos of di ongoing crackdown against illegal immigrants for di kontri

    Nigeria govment demand for autopsy and thorough investigation into di deaths and say make di South African govment make dia investigation accessible to di families of di deceased

    Afta dis move, Minister of Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukw tok say dem go evacuate Nigerians from South-Africa

    For April, Ghanaian govment bin summon South Africa Acting High Commissioner to di kontri, Thando Dalamba, to raise formal concerns ova di recent “xenophobic incidents” against Ghanaians

    On Tuesday 5 May, Ghanian govment relocate Emmanuel Akowuah Asamoah, wey dey inside one viral video wey bin show how some anti-foreigners campaigners dey harass am as im dey im shop dey work

    Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa tell Ghanaians wey wish to relocate from South Africa to Ghana say dem need to contact di High Commission and di govment go assist dem to return back to di kontri

    Meanwhile, Kenya High Commission for Pretoria don ask dia citizens wey dey reside for South Africa to “exercise caution and remain vigilant”

    Lesotho High Commissioner for Pretoria, also don advise dia citizens wey dey reside for Basotho for South Africa make dem dey veri careful becos of di protests wey dey target foreign nationals for some areas for di kontri

    Di Lesotho govment urge dia nationals to avoid places wey protest dey happun, and limit non-essential travel during dis period of high tension

    africa Against foreigners protests South
    Share. Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Email
    Jamia Ndamukong
    • Website

    Related Posts

    NTV Kenya: What is behind South Africa’s anti-immigrant protests?

    June 29, 2026

    Yoon Suk Yeol: South Korea’s ex-president jailed for life over martial law attempt

    June 29, 2026

    Protests in South Africa against foreigners: Nigeria announce plans to bring back citizens from South Africa as more anti-foreigners protests dey expected – BBC News Pidgin

    June 29, 2026
    Leave A Reply Cancel Reply

    Search
    Latest Post

    Africa’s solar energy potential makes for a bright future for renewable power

    June 29, 2026

    NTV Kenya: What is behind South Africa’s anti-immigrant protests?

    June 29, 2026

    Africa’s Formula 1 race heats up as Nigeria joins South Africa and Rwanda in bid to end 33-year wait

    June 29, 2026

    IITPSA event to unpack AI’s impact on ICT jobs

    June 29, 2026

    Canada win FIFA World Cup knockout match for 1st time: Eustáquio’s injury-time goal leads to victory over South Africa, Co-hosts in Top-16

    June 29, 2026

    Subscribe to Updates

    Get the latest creative news from FooBar about art, design and business.

    • Facebook
    • Twitter
    • Pinterest
    • Instagram
    • YouTube
    • TikTok
    ABS TV and ABS Network News is a leading Pan-African 24/7 broadcasting network delivering nonstop news, talk shows, lifestyle programs, and digital media content worldwide through Satellite, Streaming Platforms, and Roku TV.
     
    Based in the United States, we connect Africa to the world while empowering creators, journalists, and brands through innovative media and broadcasting services.
    Facebook X (Twitter) Pinterest WhatsApp Instagram

    Our Picks

    Environment

    Africa’s solar energy potential makes for a bright future for renewable power

    Lifestyle

    NTV Kenya: What is behind South Africa’s anti-immigrant protests?

    Culture

    Africa’s Formula 1 race heats up as Nigeria joins South Africa and Rwanda in bid to end 33-year wait

    Most Popular

    Technology

    IITPSA event to unpack AI’s impact on ICT jobs

    Africa News

    Canada win FIFA World Cup knockout match for 1st time: Eustáquio’s injury-time goal leads to victory over South Africa, Co-hosts in Top-16

    Trending

    Nkhalamba offers a steady hand to stranded Malawians – Malawi News | Breaking News, Politics, Business & Sports | Nyasa Times

    © 2026 Copyright. All Rights Reserved by ABSAFRICATV
    • Privacy Policy
    • Terms of Services

    Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.

    We use cookies to ensure that we give you the best experience on our website. If you continue to use this site we will assume that you are happy with it.