27 pipo die for two separate <a href="https://abs<a href="https://absafricatv.com/amref-health-africa-ceo-calls-for-action-on-health-in-africa/” title=”Amref Health Africa CEO calls for action on health in Africa”>africatv.com/separate-mass-shootings-in-south-africa-townships-leave-at-least-27-people-dead/” title=”Separate mass shootings in South Africa townships leave at least 27 people dead”>mass shootings for South Africa

Published27 September 2026
Read am in 4 mins
Twenty-seven pipo don die inside two separate mass shootings, few hours apart for South Africa, di latest gun violence to hit di kontri.
Eight gunmen kpai seventeen pipo wen dem storm one bar wey dey close to Johannesburg on Saturday evening, 26 September. 15 odas injure from di shooting.
For anoda separate shooting for di early hours of Sunday morning, 27 September, gunmen kpai10 pipo outside one entertainment venue for one township near Cape Town and 11 pipo injure from di attack.
According to di police, dem allege say patrons bin dey drink for inside and outside di joint, wen di suspects arrive and open fire for pipo wey dey outside. Di suspects enta di joint and continue dey shoot at patrons for inside.
Skip content and continue reading
- Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
- Police discover di deadi body of anoda woman for South Africa27th September 2026
- 105 Nigerians arrive from South Africa ahead of September 30 deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to comot25th September 2026
Wia dis foto come from,Reuters
South Africa get one of di highest murder rates for di world and dem don struggle to contain gang-related gun violence in recent years.
Police neva tok if any motive dey for either of di latest attacks.
For Johannesburg, gunmen bin open fire on customers outside di bar bifor dem continue di attack for inside. Dem burn two vehicles bifor dem escape.
Deputy provincial police commissioner Maj Gen Fred Kekana tok say di attack fit be retaliation for one incident wey happun last month, wey lead to di death of one pesin and anoda wounded
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
- Blue film star Ron Jeremy dey face rape allegation

Tiwa Savage and oda celebs wey face blackmail over sex tape
105 Nigerians arrive from South Africa ahead of September 30 deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to comot
South Africa police identify tenth murder victim, arrest one suspect
Speaking at di scene, e say police get clear pictures and in some cases names for di suspects.
“Di suspects dey reportedly armed wit AK-47 rifles and pistols. Dem allegedly search some patrons and collect dia cellphones bifor dem escape inside two unidentified motor vehicles,” police tok.
Police tok say dem kpai thirteen men and four women and add say di motive neva dey clear.
For Cape Town, five victims bin die for di scene and anoda five pipo die for hospital.
Dem neva make any arrests for any of di case on Sunday morning.
Authorities say dem don launch manhunt to find and arrest di suspects.
Gauteng police say dem don mobilise one team of detectives and oda specialised units to trace and apprehend the suspects.
“Police don open 17 counts of murder, 15 counts of attempted murder and two counts of malicious damage to property.”
Di two mass shootings dey come few days afta gunmen kill at least 11 pipo for inside one mass shooting for one residential building near di South African city of Durban.
Di gunmen bin storm one house for KwaMakhutha township on Tuesday night, dem open fire on 14 pipo.
Illegal weapons full South Africa and gun violence na one constant problem for dem for decades.
Authorities dey record about 60 murders evriday for di kontri of 62 million pipo.
But one recent spate of mass shootings don raise fears say di problem don pass be careful, as authorities don often link di violence to kasala between gangs wey dey engaged in drug trafficking and illegal mining.
For February, President Cyril Ramaphosa bin call organised crime “di most immediate threat to our democracy, our society and our economic development”.
Earlier dis year govment deploy military plus police to areas wey get di highest murder rates as part of effort to reduce armed violence.
Fotos from scenes of di mass shootings





