Wia dis foto come from,Great Ovedje Ogboru/ Pat Utomi/Atiku Abubakar
Published3 hours wey don pass
Read am in 6 mins
Di coming 2027 general elections for Nigeria don bring to mind some ogbonge politicians wey don try several times to win elective positions but dem no fit, either say dem no get wetin dem want or dem no even get at all.
Nigeria start dis current cycle of democratic system of governance for 1999, afta di kontri military bin dey in charge for many years and power bin dey change hands through coup d’états.
Since dat ogbonge election of 1999 wey bring in Olusegun Obasanjo as president, some politicians don dey try to get diasef into particular positions, but e neva sup for dem, while for some odas, no be di particular position wey dem dey go for dem get, so dem continue to search.
Dis article torchlight some of dem:
Skip content and continue reading
- Which options dey available for Atiku and ADC ahead of 2027 election6th November 2026
- At least seven pipo kpai and ova 100 injure afta train collide for Egypt8th November 2026
- Minister of Power Tegbe break silence on cause of blackout for Nigeria7th November 2026
Atiku Abubakar
Wia dis foto come from,Atiku Abubakar
Even though Alhaji Abubakar na di vice President of Nigeria unda President Obasanjo, history don show say dat number two position for di kontri no be really im main ambition, but na to be di number one.
Tori be say oga Atiku folo drag di presidential primary election of di Social Democratic Party (SDP) wey produce Alhaji Moshood Abiola for di June 12, 1993 election.
Even though dat election hold and di general consesus be say na Abiola win am, di military govment of Ibrahim Babangida dat time cancel di election and remain power.
So, wen di military wan handover power, Atiku bin contest and win di govnorship ticket of Adamawa State unda di Peoples Democratic Party, but Obasanjo later tap am to be im running mate and na so e take bicom VP afta dem win.
Wen Obasanjo tenure end for 2007, Atiku try to get di PDP presidential ticket for di 2007 election, but e lose to di late President Musa Yar’Adua. And since dat time reach now, di former Vice President name dey always dey mentioned for evri election cycle as e dey always wan run for President.
For 2023, e contest unda di PDp and for di 2027 general election, Atiku na di presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC).
Great Ovedje Ogboru
Wia dis foto come from,Great Ovedje Ogboru/Facebook
Great Ogboru don dey run for di office of di govnor of Delta State since 2003, and e go still contest for di coming 2027 poll.
For 2003, Ogboru run unda di platform of di Alliance for Democracy (AD), in 2007 and 2011, e contest unda di Democratic People’s Party (DPP). In 2015, e also contest wit di Labour Party, and by 2019, e join di All Progressives Congress (APC) wia e also contest and lose to Ifeanyi Okowa.
In 2023, oga Ogboru also contest again, dis time unda di All Progressives Grand Alliance (APGA, and e come seventh position.
E dey contest again in 2027 unda di ADC.
Donald Duke
Wia dis foto come from,Donald Duke
Immediately afta completing im secon tenure as di govnor of Cross River State for south-south Nigeria in 2007, Donald Duke set im target for di number one office of di nation.
E announce im presidential ambition in 2007 on top di PDP, but e later withdraw from di race and endorse Musa Yar’Adua who later win di election.
Again in 2019, oga Duke also contest for di presidential seat unda di platform of di Social Democratic Party (SDP), but e lose.
For di 2027 elections, Donald Duke na di presidential candidate of di Peoples Redemption Party (PRP).
Pat Utomi
Wia dis foto come from,Pat Utomi/Facebook
Even though im name no dey di ballot for di 2023 elections and e no go dey for di forthcoming 2027 polls, Patrick Okedinachi Utomi, commonly known as Pat Utomi, na anoda Nigerian wey don try and fail several times to win di number one position for di kontri.
In 2007, Utomi, wey be expert for Economics mata, contest for di presidency unda di African Democratic Party (ADP). E lose. Den for 2011, e switch to di Social Democratic Mega Party (SDMP). E lose again.
In di 2023 general election, Utomi bin don dey sure to secure di Labour Party presidential ticket, but e step aside and throw im weight behind former Anambra State govnor, Peter Obi, who bin just join di party few days earlier afta e japa from di PDP.
Obi later run di race for LP but come third overall, behind President Bola Tinubu of di APC and Atiku Abubakar of di PDP.
For di coming 2027 polls, Utomi still dey support Obi for president.
Chris Okotie
Wia dis foto come from,Pastor Chris Okotie/Instagram
Di former pop singer wey later bicom one of di ogbonge Christian preachers for Nigeria, also try to bicom president of di kontri, but e no gree am.
Three times, Okotie contest for di president of Nigeria. In 2003 unda di Justice Party (JP) and in 2007 and 2011 unda di Fresh Democratic Party (FDP) we e be di founder.
Bifor di 2015 elections, Inec comot FDP from di register of political parties for Nigeria bicos dem no meet di criteria to continue to dey exist. One of di criteria na say a party suppose win at least one seat for at least a local council election.
But even wit dat, Okotie tok say im go challenge dat Inec decision for court and im go still contest di election.
Also in July 2018, as di 2019 elections dey come close, Okotie declare during one Sunday service for im church say im go contest di presidential election, and tok say God ask am to write letter to di PDP and APC to adopt am as dia consensus candidate. Of course dat one no hapun.
For one interview wit BBC News Pidgin in 2022, oga Chris Okotie tok say im neva give up to lead Nigeria one day.
Adamu Maina Waziri
Adamu Waziri don dey contest since 2003 to bicom govnor of Yobe State, but e never work for am.
For 2003 and 2007, Waziri contest unda di PDP but e lose both times to di candidates of di All Nigeria Peoples Party (ANPP).
In 2011, E also try to be govnorship candidate but e lose di PDP primary to Usman Albishir. Den in 2015 e manage to win di PDP ticket but lose di main gonorship election to Gaidam Ibrahim of di APC.
For di general elections of 2019, Waziri step down to run for a senate seat, and even though one faction of di PDP declare am winner for di primaries, Inec no recognise am as di authentic candidate.
For dis coming 2027 elections, Waziri wey don be Minister two times, dey also contest for di House of Representatives unda di ADC.
