271 more Nigerians go arrive from South Africa on Friday as evacuation continue sake of anti-immigration protests
Published10 minutes wey don pass
Read am in 3 mins
Anoda batch 271 Nigerians go touchdown di Murtala Muhammed Airport, Lagos dis Friday morning from South Africa, as di Nigerian govment continue to evacuate dia citizens sake of violent anti-immigration protests wey dey go on for di kontri
Protesters for South Africa bin give African Immigrants for di kontri until 30 June 2026 to go bak to dia kontris, sake of accuse say na dem dey behind di rising crime, drug business and unemployment for South Africa
Di protests don also lead to di death of several nationals of differenct African kontri, including one Ghanaian wey di Ghana govment tok say dem kill am on dat 30 June deadline day, even though di South African govment don deny am
Friday evacuation flight go be di third batch of pipo wey dey come bak wit flights arranged by di govment tru di Federal Ministry of Foreign Affairs
Di first batch of 258 pipo bin arrive Nigeria on 11 June 2026 through Air Peace, while on 24 June, di second batch of 66 pipo arriveian on June 24, and on 30 June di third batch of 269 pipo arrive
Skip content and continue reading
- ICC go kontinu to dia work despite Burkina Faso, Niger and Mali withdraw from International Court2nd July 2026
- Challenges wey Inec chairmen don face since Nigeria return to democracy for 19992 hours wey don pass
- Factcheck: Presidential Economic Advisory Council really get allocation for 2026 budget?2nd July 2026
“Three additional flights go dey operated in di next few days to make sure say evri Nigerian wey voluntarily register to be evacuated, and wey we don screen and clear, go come bak safely to di kontri,” Kimiebi Ebienfa, di tok-tok pesin for di Ministry of Foreign affairs tok for one statement on Thursday
Di Ministry also point out say during di second batch, wen dem bin encounter some logistics challenge, “one good-spirited Nigerian bin offer to voluntarily pay for di flight ticket of 66 (out of di 269 pipo for dat batch)”
Apart from dis 66 pipo, “all di special evacuation flights dey fully paid for by di Federal Govment wit no cost to di returnees”
Di Ministry tok say lie-lie tori don dey fly around say some of di Nigerian missions bin dey request moni bifor dem go put pipo name for di list of evacuation
“Dat na totally false, fake news, and pipo no suppose send am,” Ebienfa tok for di statement
Di total numba of pipo wey di Nigeria govment still dey hope to carry come back from South Africa na about 700, but di Foreign Affairs Ministry no to exactly wen di next evacuation flight go be
Earlier in di week, di Foreign Affairs Ministry tell di BBC say dem go consider demandi for compensation from di South African govment, for many Nigerians wey abandon dia valued property and livelihoods in order to save dia lives
