Why two Ghanaians petition ICC to investigate xenophobic attacks for South Africa
Wia dis foto come from,EMMANUEL CROSET/AFP VIA
Published37 minutes wey don pass
Read am in 6 mins
Two Ghanaians don petition di international Criminal Court (ICC) to chook eye for di xenophobic attacks against foreign nationals for South Africa.
According to dem, dis attacks wey don cause deaths, injuries and looting of shops be crime against humanity, under Article 7 pf di Rome Statute.
Dr Palgrave Boakye Danquah wey be ex-Ghana govment tok-tok pesin on governance and security togeda wit security sabi pesin Emmanuel Kotin, bin petition di ICC on 15 July, wey dem demand among oda tins say South Africa authorities gatz take serious action now.
Inside di petition to di office of di prosecutor of di ICC for di Hague, Dr Palgrave and Emmanuel Koti say “di ICC gatz begin preliminary examination into di repeated xenophobic attacks for South Africa wey cause illegal killing s, assault, displacement and destruction of property wey belong to civilians and foreign nationals especially African migrants.”
Dem also explain say “for years, dem beat our African brothers and sisters wey dem sack odas for dia homes for di kontri.”
Di two Ghanaian security sabi pipo add say “state authorities don fail to prevent, investigate and punish dis crimes.”
Skip content and continue reading
- ‘Employ mostly South African citizens or permanent residents’ – South Africa tell employers under new scheme22nd July 2026
- Nigerian Army announce killing of Boko Haram chief photographer, oda members22nd July 2026
- Top five Nigerian ministries wey ICPC say get fake workers22nd July 2026
Dia three-point call for di ICC
- Preliminary examination of di situation for South Africa
- ICC gatz summon and question President Cyril Ramaphosa and oda senior govment officials ova dis mata
- Ensure accountability to stop more violence
According to di petitioners, dis no be attack on di pipo of South Africa, “na to call for justice and protection of human dignity.”
“We be Africans, di blood of one Nigerian, Ghanaian, Zimbabwean, Mozambican or Malawian wey die for South Africa, be di blood of all of us.”
Dem also ask African Union, Ecowas and oda human rights pipo to support di process and speak up against xenophobia.
Wia dis foto come from,FRENNIE SHIVAMBU/
Skip content and continue reading
- Ghana go conduct independent autopsy as bodi of citizen wey dem kpai for South Africa return home16th July 2026
- Ghana authorities go begin repatriation of ‘final batch’ of 900 citizens from South Africa on 25 July15th July 2026
Wetin South Africa tok about dis petition
According to Reuters, one tok-tok pesin for South Africa foreign ministry say di petition be opportunistic, wia im tok say e fail to meet di legal jurisdictional requirements for di ICC to act.
Di ministry toktok pesin Chrispin Phiri say “South Africa get sophisticated and domestic legal framework” wey dia laws dey provide comprehensive solution and enforcement against discrimination, intolerance and odas.
Di petitioners tok BBC News Pidgin say di ICC don ask dem to provide more evidence for di mata, wey dem bin dey do just dat.
Dem say make South Africa authorities allow di ICC to do dia work and decide wetin dem go do, no be for South Africa to “be judge for dia own cause.”
South Africa president Cyril Ramaphosa bin condemn attacks on foreigners for di kontri during widespread anti-immigration protests.
But im also tok say law enforcement dey deal wit illegal immigration wey dey stretch di kontris re
Di kontri say dem deport ova 53,000 foreigners since dem begin to clamp down on illegal immigration for di kontri.
Ghana president John Mahama say African Union gatz act for dis mata
Wia dis foto come from,GHANA PRESIDENCY
President John Mahama say di African Union (AU) gatz take “active interest for di recurring xenophobic attacks for South Africa.”
For one meeting wit di chairperson for di AU commission Mahamoud Ali Youssou for di Ghana presidency for 22 July, oga Mahama tok say “we no fit ignore dis attacks anymore.”
“We bin charter planes to evacuate our citizens for South Africa, wey cost plenty money, we dey charter anoda set to bring back 900 oda citizens.”
Di president add say “we don pay dis returnees reintegration allowance, I tink di AU gatz take interest sake of e fit scata everitin we don work for to achieve African integration and solidarity.”
President Mahama say “we go put dis mata for di agenda for di next AU meeting.”
Di president also dey worried say South Africa authorities no dey treat dis mata seriously.
“Dem kill two of our citizens, but South Africa authorities no dey respond to di magnitude wey dem for respond to dis mata; dem sabi di pipo wey dey put fire for dis attacks, but dem dey walk free to do wetin dem like wit impunity.”
Wia dis foto come from,EMMANUEL CROSET/AFP VIA
Ghana president also tok say South Africa president bin send one team to Ghana to discuss di situation.
“On 21 July President Ramaphosa bin send delegation to me wey I tok dem why we gatz discuss dis mata. When dis tins happun wey we sweep dem under di carpet, we neva dey cure di problem.”
Im add say “I tok di delegation say Ghana no get any hard feelings against South Africa but we dey raise di mata so say dem go get platform to explain wetin dem dey do to fix di issue, wit di world.”
On 14 July, body of 40-year-old Bashiru Isak wey dem kill for South Africa return home for autopsy and burial.
Ghana authroities say di death dey connected to di fresh wave of xenophobic attacks and anti-immigration protests, but South Africa police deny dis claim.
Dem say Bashiru Isak die for “extortion-related crime.”
Ghana don repatriate about 1,000 citizens from di rainbow kontri; anoda set of 900 dey prepare to return, as Nigerian, Zimbabwe, Malawi, Zambia, Ethiopia, Kenya and odas continue to evacuate dia citizens due to threats to dia life and properties.