Wia dis foto come from,RAJESH JANTILAL / AFP
Published24 June 2026
Read am in 4 mins
Leaders of di anti-migrant movements and some civic society groups wey include di March and March tok say di 30 June deadline for undocumented foreign nationals to leave South Africa no dey change
For one news conference on Wednesday, 24 June ahead of di deadline, Jacinta Ngobese-Zuma, leader of di March and March movement clear am say no be dem choose di date, but na South Africans wey wan see di kontri take shape
Ngobese-Zuma also clear am say dem no dey plan to shutdown di kontri for dat day, and dia target no be only black foreigners, but any foreign nationals wey dey live for dia kontri illegally
As she dey ansa questions from tori pipo on wetin go happun on di day, di March and March movement leader say di demonstration dey expected to dey peaceful, as she reject accusations say di protest dey promote violence against foreigners
Ngobese-Zuma plus oda representatives from di several civil organisations repeat am say di demonstration na to put pressure on di govment to compulsory immigration laws, secure di borders and address wetin organisers describe as illegal immigration crisis
“Di 30 June deadline no eva dey about violence. E no eva dey about shutting down di kontri. E no eva dey about harming anybodi. All we dey ask na for illegal immigrants to leave our kontri and for govment to enforce di laws wey already dey exist,” she tok
Skip content and continue reading
- How two buildings collapse for Lagos and Rivers states within 24 hours trap and kpai pipo26th June 2026
- African kontris wey don comot dia citizens from South Africa sake of xenophobic attacks as Nigeria welcome 26811th June 2026
- ‘Dem say dem go do house to house search’ – Nigerians cry out ahead of June 30 for migrants to comot for South Africa24th June 2026
End of content
Di 30 June deadline don bicom rallying point for several civil organisations wey don align demsefs wit March and March campaign against illegal migration
Organisers say communities across di kontri and South Africans abroad dey in support of di initiative, becos dem believe say di govment don fail to respond to dia concerns about porous borders plus di pressure on public amenities and high unemployment for di kontri
As fears dey say di protest fit escalate and trigger tension, Ngobese-Zuma maintain say organisers dey committed to peaceful action and condemn pipo wey dey criticise dia intention
Di South Africa minister of police bin meet wit oda national commissioner as part of dia preparation for di protests on Monday
Local media DailyMaverick bin quote wia di police minister say South Africans get di constitutional rights to protest, but no go allow any act of lawlessness or violence
“Di aim of di operations na to make sure say all foreign nationals wey dey stay for South Africa fit stay for di kontri legally and get valid documentation.”
South Africa Minister of Justice Mmamoloko Nkhensani Kubayi dey monitor di evacuation of some foreign nationals
Di justice minister dey part of di Inter-Ministerial Committee (IMC) on Migration, and dem dey monitor how some migrants comot for South Africa by buses
Dem also visit di king of KwaZulu, King Misuzulu kaZwelithini, for di Royal House wia dem go tok how govment dey make efforts to manage migration for di kontri
Di acting Minister of Police, Cachalia bin dey do meeting wit Defence Minister, Motshekga ontop dis June 30 demonstrations, but di outcome of di meeting neva dey public
Meanwhile, dem say na closed door meeting and media no go fit capture wetin dey happun inside, but na until afta di meeting di minister go tok
Meanwhile, dem don mark some provinces wey di protests don already affect and na di Gauteng, KwaZulu-Natal, Western Cape, and Eastern Cape provinces
As di days dey go by, oda Africans especially Nigerians dey fear for dia lives as dem no know wetin go happun to dem wen di protests really start
Tori of how African kontris dey remove dia citizens from South Africa full evriwia
Sake of di different protests wey don hpappun for South Africa wey don lead to harassment of foreign nationals, kontris like Ghana, Nigeria and Malawi begin remove dia citizens since di threats bin start
Accounts of immigrants wey don lose evritin, na real life tori for South Africa
Di account of di Nigerian trader and businessman Wilson Oghodero show say Nigerian citizens wey dey live for South Africa dey under pressure
Wilson tell BBC say di groups don warn say dem go carry out house to house search for documentation afta di deadline
Dis don make tension dey rise among Nigerians wey still dey South Africa wey don register to leave di kontri
Afta di first batch of Nigerians wey return to di kontri, anoda set land for Murtala Muhammed International Airport for Lagos on Wednesday afta days of delayed evacuation wey leave hundreds of pipo to dey wait as tension ova immigration continue to dey grow for South Africa
