Wia dis foto come from,Per-Anders Pettersson/

Wetin we call dis foto, Officers for di South African Police Service (SAPS) participate for one parade for FNB Stadium on June 26, 2026 for Johannesburg, South Africa.

Published4 hours wey don pass
Read am in 5 mins

South Africa Police Service ready gidigba and don deploy law enforcement officers across di kontri to maintain law and order, protect lives and safeguard property, ahead of di 30 June anti-immigration protest

Di Acting Minister of Police Firoz Chachalia give dis informate as dey inspect one parade wey go dey deployed for di Tuesday demonstration for Durban, Kwa-Zulu-Natal on Sunday, 28 June

Oga Chachalia tell di officers say dia role no be to take sides for any public debate, but to protect both di rights of dos wey choose to protest and di rights of pipo wey dey work and live for affected communities

“South African Police Service no dey deployed to prevent lawful demonstrations. We dey deployed to ensure say di protest take place safely, securely and for orderly manner. We dey there to protect life, safeguard property, prevent criminality and respond swiftly to anybody wey wan use these legitimate grievances to commit acts of violence, intimidation, vandalism or any oda offence.”

E also say dia role na to uphold di Constitution, enforce di law without fear, favour or prejudice, and ensure say public order dey maintained

Di police dey gada momentum ahead of di 30 June deadline wey anti-migrant group March and March, opposition party ActionSA plus odas don set for undocumented migrants to leave dia kontri

Skip content and continue reading

Breakdown of security measures across SA provinces

For inside one wide joint effort to avoid violence ahead of di marches, nearly 10,000 volunteers don dey mobilised to closely monitor dia communities, particularly for Kwazulu-Natal, di epic centre of di protest action

Police dey deploy thousands of officers as part of dia operational strategy to ensure say di protest no turn violent. Dem also don involve private security companies, businesses, religious and traditional leaders, plus unions to ensure peaceful demonstrations

Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading

  • France react as Burkina Faso cut diplomatic relations wit di kontri

  • South Africa vs Canada World Cup Round of 32 match preview
  • ‘To start akara business no cost plenty money’ – Nigerians dey divided ova First Lady Remi Tinubu comments

  • Anti-migrant protesters say June 30 deadline for migrants to comot for South Africa still stand

However, organisers of di march for one earlier press briefing tok say dia plan no be to shut down di kontri

Ngobese-Zuma plus oda representatives from di several civil organisations repeat am say di demonstration na to put pressure on di govment to compulsory immigration laws, secure di borders and address wetin organisers describe as illegal immigration crisis

Johannesburg Metropolitan Police Department (JMPD)

Police authorities for various regions also dey take action to ensure say di protest dey peaceful

Di Johannesburg Metropolitan Police Department (JMPD) say law enforcement officers currently dey on ground to monitor series of spontaneous marches for di region on Sunday

Ahead of di 30 June demonstration, Johannesburg police say three legally approved marches dey scheduled to take place simultaneously across di Johannesburg inner city, Hillbrow and Midrand (Glen Austin)

Di planned march routes and target areas include: Kliptown, Moroka and Lenasia

Dem warn motorists, commuters and residents wey dey travel through Johannesburg to plan ahead, as traffic go full town dat day

Di police say dem don deploy law enforcement teams wey include JMPD and SAPS Public Order Policing across di city to monitor procession routes, manage traffic flow and ensure public safety

Mpumalanga Province

Di Acting Provincial Commissioner of SAPS for Mpumalanga, Maj Gen Zeph Mkhwanazi say di Police for Mpumalanga dey ready to ensure say 30th of June bicom normal working day wia pipo for dat province go perform dia duties as expected, without any intimidation or threat

E say police no go allow criminal elements hijack di protest as lawlessness go dey met wit lawful, firm, and professional policing

“Make nobody go loot any shop, make nobody break enter any shop, and no tyre suppose burn for road,” Mhhwanazi tok

E call for police visibility for all identified routes, hotspots, and critical infrastructure, wey include for all roads and boarders

Kwazulu-Natal province

Police for Kwazulu-Natal say dem ready to protect South Africans as dem exercise dia constitutional rights

Acting Provincial Commissioner of KwaZulu-Natal Major General Phumelele Makoba say dem go create secure environment for dos wey dey march, and watch make criminal elements no hijack di peaceful marches

How di protest go waka

Johannesburg don release details on how di protest go take waka for di kontri capital

Authorities say di first march wey di March and March group organise go focus on inner-city, youth development and access to community services

About 5 000 protesters dey expected to gada for Beyers Naudé Square bifor dem march go Constitution Hill, wia dem go handover one memorandum give di Hillbrow Station Commander

Di procession go start at 10:00 and continue until 14:00. Dem go march along Helen Joseph Street, Troye Street, Twist Street, Kotze Street and Queen Street

Di second march wey di Labour and Civic Organisation (LACO), dey expected to draw around 1 200 participants

Di march aim na to raise concerns around illegal immigration policies and engage di Department of Home Affairs

Participants go gada for di intersection of Kotze and Hospital streets for Hillbrow bifor dem march go di Department of Home Affairs on Plein Street. For there, dem go submit one memorandum

Di procession dey expected to run from 09:00 to 12:00

For Midrand, di Mayibuye Youth Activism Movement go lead one labour march wey dey focused on youth employment opportunities

Around 800 participants dey expected to gada for di Dale Road and Modderfontein Road open space bifor dem march go Sandton Plant Hire Offices to submit one memorandum wey relate to local employment concerns

Dis procession go run from 10:00 to 12:00, with dispersal expected at 13:00

Countries wey don evacuate dia citizens

Thousands of immigrants don already leave South Africa ahead of di deadline and as protests against undocumented migrants dey rise

Nigeria, Ghana, Malawi, Mozambique, and Zimbabwe don don bring back dia citizen wey express interest to leave South Africa in different batches

Uganda na di latest African kontri to announce repatriation of dia nationals in the coming days

For one statement wey di acting Minister of Foreign Affairs Haruna Kasolo issue on Sunday, e say currently, 746 Ugandans don register to leave South Afica sake of security and safety concerns, and more dey expected to register

E say dem go leave in di next few days once dem finalize di evacuation plan

Share.
Leave A Reply

Exit mobile version