Battle wit cancer: Nigerian actor Ogogo don die?
Wia dis foto come from,@ogogotaiwohassan/Instagram
Published18 August 2026, 07:48 WAT
New Informate one hour wey don pass
Read am in 4 mins
Afta di pikin of veteran Yoruba actor Taiwo Hassan alias Ogogo, announce say e battle cancer, fans and loved ones don dey pray for im recovery.
However, as dis dey happun tori begin begin spread say di Yewa-born actor don die.
Di rumour of im death shaparly spread for social media on Tuesday – one day afta im children, Kira and Lima, announce dia papa sickness.
Lima, Ogogo second pikin, bin do Instagram post to announce her papa death but she immediately delete am.
Di post wey no spend up to thirty minutes don already go viral.
Skip content and continue reading
- Di Adeleke dynasty: How one family become powerful force for Osun politics17th August 2026
- Trump don threaten to bomb Oman if dem ‘come dey disturb am’ ova Iran issue17th August 2026
- <a href="https://absafricatv.com/south-africa-introduces-r500-visa-fee-five-days-after-launching-new-online-travel-system/" title="South Africa introduces R500 visa fee five days after launching new online travel system”>South Africa anti-immigration group give anoda deadline for illegal immigrants to leave, protest outside SADC summit for Durban17th August 2026
Ogogo bin trend on Monday, 17 August and Tuesday afta im daughter Kira Taiwo cry for video wey don dey go viral on social media say im papa bin dey struggle wit stage 4 cancer.
“I no want my papa to die,” dis na some of di words from Kira for di viral video as she say hospitals wey dem carry her papa go, no gree treat am again.
She bin ask di public if dem know anybody or facility wey fit treat her papa to reach out to dem.
“I dey hia to ask for help for my papa, im get cancer and e dey really really bad. Many hospitals no gree treat am, at least, abeg make una give dis man chance.
“Nobody wan do anytin, we no dey ask for money, if you know pesin wey know pesin wey fit treat am, make una help,” she tok.
Im daughter add say she no fit imagine say her papa go die and add say wetin dey pain her pass be say her papa get strong will to live.
“Dis man get strong will to live. If you see am you no go even know say somtin dey wrong wit am wey bad well-well, e just start to dey show.”
According to Kira, di cancer just begin show and na three weeks ago dem diagnose am of di life-threatening disease.
“We bin no even know untill like three weeks ago, so abeg, I dey beg una, if you know pesin wey know anoda pesin wey go fit treat am, we dey ready to try anytin, abeg we no dey hia to ask for money.”
She add say her papa dey suffer from stage four cancer and her big uncle na im dey help wit di hospital bills since dem notice say im get cancer.
“I no want make my papa die, hospital dey tok say dem no go fit treat am again.
“I no dey here to beg for money,” di actor daughter tok.
Who be Taiwo Hassan?
Taiwo Hassan na Nollywood actor, wey dey popular for im multiple roles for di Yoruba feems.
Im don dey act for veri long time and na face wey pipo wey dey watch feem well-well fit recognise.
Ogogo na 66 years old and na ogbonge actor for Nollywood. Di actor also dey known for im beautiful voice wen e dey chant.
E come from di family of twins. Im forefather na Taiwo, di one wey follow am na Taiwo, im papa na Taiwo and im mama give birth to twins four times.
Ogogo na di last of im parents twins wey kpai. Im parents born thirteen pikin dem wey remain three.
Ogogo na trained boxer wey no dey hide im boxing skills.
Di actor bin battle chronic ulcer for six to seven years wey bin nearly take im life.
Im best friend na Yinka Quadri – e say no friend wey im don eva love like dis fellow actor.
‘Na all of us go chop breakfast’ na famous Ogogo line for one Yoruba movie wey become street slang.
Tori be say im acting career don pass forty years and im don act ova 300 feems for Yoruba. One of di ogbonge feems wey im act and wey blow well-well na Owo Blow wey dem release for 1996 and directed by Tade Ogidan.
Pipo also sabi Ogogo as pesin wey get action inside feems wit di way e dey act, im aura and how e dey carry imsef. Na dis im action create di Yoruba street slang, ‘Action Po bi Ogogo,’ wey mean ‘Action Plenty like Ogogo’.
